Students die as military crush terrorists plan to kidnap students of Federal Government Girls College Monguno

Wia dis foto come from, OTHERS
Some students of di Federal Government Girls College Monguno for Borno state, northeast Nigeria don die as stray bullets from terrorists hit dem wen Nigerian security personnel exchange fire wit dem wen dem attack di school.
Di Nigerian military wey give di informate no tok how many students die for di crossfire, but dem say troops successfully rescue and evacuate 46 students go Kinnasara Barracks, Monguno, wia dem dey receive immediate medical assessment and appropriate care.
According to di Nigerian Army, di Islamic State West Africa Province terrorists bin attack di girls college at about 1:30am on Sunday, 19 July claim say Islamic State West Africa Province terrorists bin attack di girls college at about 1:30am on Sunday, 19 July, as dem attempt to kidnap di students for inside one mass abduction operation.
However, security agents immediately land di school and engage di terrorists wit coordinated and overwhelming firepower, dem overpower dem, force dem to abandon dia mission and di military surround di school.
"No sigle student dey kidnapped," di military affirm.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wetin authorities tok about di attack
Di school, wey dem currently dey use as temporary accommodation for polytechnic students, bin come under attack bifor joint security forces, wey include di military and police, respond.
Di Nigerian Army for statement wey Mohammed Goni, di acting Military Information Officer Hadin Kai for Maiduguri issue, tok say di terrorists reportedly gain access to di facility wit di assistance of suspected collaborators in an attempt to abduct students.
"Confronted by di superior combat capability and determined resistance of di security forces, di terrorists bin dey forced to abandon dia criminal mission and run in confusion without achieving dia objective, di army tok for statement.
During di encounter, some parts of di school infrastructure bin sustain damage but the attempt was well contained by troops in conjunction with the Nigeria Police Force personnel.
"Afta di operation, di troops successfully rescue and evacuate all 46 students go Kinnasara Barracks for Monguno, wia dem quickly check dia health and give dem di medical care wey dem need. All di rescued students don dey confirmed say dem stable medically, and no single student dey abducted.
"Unfortunately, some students lose dia lives afta stray bullets from di terrorists hit dem during di exchange of gunfire between di troops and di terrorists".
Operation Hadin Kai say dem still dey on top di mata as dem dey try to identify and apprehend di suspected collaborators, while troops and oda security agencies dey actively track di terrorists wey run.
Also, di military tok sorry to di families of di deceased and reassure di public say dem dey take all necessary measures to safeguard di lives of residents and protect critical public institutions across di North East in collaboration wit di Borno state govment.
Schools for northern Nigeria don repeatedly bicom targets by armed groups, and mass kidnappings don dey bicom hallmark of di kontri security crisis ova di past decade.
Dis latest attack dey come afta Nigeria security agencies recently rescue 40 pupils and teachers wey terrorists kidnap from Oriire Local Government Area of Oyo State for 15 May 2026.
Nigerian President Bola Tinubu bin name Ansaru terrorists group as di group behind di Oyo kidnapping.
Di abducted school children and teachers bin regain freedom, 56 days afta dia abduction from dia schools for Oriire community for Ogbomoso, Oyo State, di Presidency tok.
Few days afta di release, di Nigerian govment file charges 10-count charges against three suspects wey allegedly get hand for di kidnapping.
DI 10-count charges wey govment don already file for di Federal High Court, Abuja border on terrorism, kidnapping, concealment, incitement and illegal mining.
Meanwhile, on di same day di Oyo school kidnap happun, unknown gunmen also kidnap 40 schoolchildren from Mussa village for Borno State, and dem still dey miss.
Di attempted attack for Monguno show di continuing threat wey di Islamist militants for north-eastern Nigeria pose, despite years of military operations aimed at protecting schools plus oda civilian targets.
Nigeria don increase military spending and dem don expand security cooperation wit international partners, but attacks by jihadist groups and oda armed gangs continue, and violence continue to spread to new parts of di kontri.











