Unknown hackers hack Kenya president Ruto official website demand bitcoins worth $320,000

President William Ruto

Wia dis foto come from, Getty Images

Published
Read am in 3 mins

Unknown hackers don hack di official website of Kenyan President William Ruto.

Di attackers dey demand ransom of 5 bitcoins, wey worth approximately 41 million Kenyan shillings (about $320,000) from authorities bifor 6:00p.m. local time on Saturday, according to local media reports.

Di hackers disfigure di homepage of di president website and replace official contents wit offensive messages wey dey target di Kenyan leader and dem threaten to leak sensitive govment information.

Di Ministry of Information, Communications and The Digital Economy wey confam di incident tok say ICT authority don immediately activate establish cybersecurity incident response protocols and dem dey work closely wit relevant govment agencies and technical partners to carry out comprehensive forensic investigation and establish di full circumstances surrounding di incident.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Di cabinet secretary of di ministry William Gitau for statement say dem don temporarily restrict access to di Presidential website to facilitate containment, forensic analysis and restoration efforts.

"We don since implement appropriate mitigation measures, and restoration of di website dey underway," Gitau tok.

Di cabinet secretary also say "evidence of unauthorized access to sensitive data, data exfiltration, or loss of information no dey. Govment systems and digital services remain secure and operational."

According to local tori, di official website, president.go.ke, currently no dey available and e dey show di following message: "Sorry for di inconvenience but we dey perform some maintenance at di moment. We go come back online shortly!"

Kenya.co.ke report say di page also show allegations against Ruto, one cryptocurrency wallet address plus demand for payment, as di hackers threaten to release unspecified information if dem no meet dia demands.

Di hackers also change di website banner, but di official State House branding still dey visible for di background. Govment, however, don remove di website.

Di incident dey come just months afta one major cyberattack for November 2025 wia di hackers bin target several govment websites for inside wetin authorities describe as coordinated attack.