Top Champions League matches to watch out for and who be favourite clubs wey fit win di trophy

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Uefa Champions League don come back wit six ogbonge matches dis Tuesday, and already, football fans around di world don dey ask: who go win dis famous trophy for Madrid on 5 June next year?
Paris St-Germain of France go dey hope to win di title for di third year back to back, but five English teams go dey try to stop dem.
Arsenal, wey be current champions of di English Premier League go try to do beta dan last season wen dem finish second, losing to PSG on penalties for di final.
Tuesday fixtures
FC Porto vs Manchester City - 8 PM
Manchester City go start dia life for Europe for di first time in 10 years witout dia legendary manager Pep Guardiola, but im replacement - Enzo Maresca don start well for di EPL wit three wins for three matches.
City bin spend beta moni for di summer transfer window to buy new players like Enzo Fernandes, Elliot Anderson and Ayoub Bouaddi, to replace some of dia legends wey comot last season, like Rodri, Bernado Silva and John Stones.
So all eyes go dey on di Citizens to see how dia new team fit gel togeda for Europe.
Also FC Porto, wey be di current champions for di Portuguese Super League, no be walkover team, especially wit dia new 37-year old manager Francesco Farioli, wey dey considered as one of di fastest-rising stars in coaching.
Real Madrid vs Inter Milan - 8 PM
Jose Mourinho don come back to Madrid, and dat alone na reason to look forward to season wey fit dey interesting for di Spanish giants.
Also, Dutch wing back Denzel Dumfries go dey face im former club, afta e mover from Inter to Madrid for dis summer transfer window.
Di Santiago Bernabeu boys bin impress for dia first three La Liga matches wey dem win, bifor narrowly losing 1-0 to Real Betis last weekend.
Players to watch na definitely Kylian Mbappe and Jude Bellingham wey don show good form in front of goal so far dis season.
Inter Milan, for dia own side, na one of di traditionally strong clubs for Europe, and Mourinho bin don win di Champions League wit dem for di 2009/2010 season.
Dia coach now na Christian Chivu, wey be one of di players for wen Inter win di Champions league wit Mourinho for 2010, so na battle of pipo wey sabi diasef wella.
Club Brugge vs Aston Villa - 5:45 PM
Villa na di champions of di Uefa Europa League last season, but dem don start very badly for dis season witout any goal for dia first three EPL matches.
Dia coach Unai Emery dey still try to put im new team togeda afta some of dia biggest names like Morgan Rogers, Ollie Watkins, Ezri Konsa and Youri Tielemans bin comot.
Club Brugge on di oda hand don dey show workings and consistency, winning four out dia first five matches so far for di Belgian Pro League.

Wia dis foto come from, Getty Images
Borussia Dortmund vs Villareal - 8 PM
Di BVB dey come into dis mtch wit some injury concerns especially for dia defence, as ogbonge players like Schlotterbeck, Can, Mane and Bensebaini all dey absent.
Di club also lose one of dia beta forwards Karim Adeyemi during di summer transfer window as e join Spanish champions, Barcelona.
Howeva, dem still get exciting talents like Jobe Bellingham, younger broda of di Real Madrid Star Jude Bellingham, as well as two players of Nigerian descent Felix Nmecha and Carney Chukwuemeka.
Villareal also go dey hope for beta luck for dis match as dem neva win for dia first four La Liga games - two draws and two loses.
Dia coach, Iñigo Pérez, tok say dem gatz detach diasef from wetin bin don happene for dia past games and focus entirely on dis match.
Lille vs Real Betis - 8 PM
Both teams don start well so far dis season, wit Betis beating Real Madrid 1-0 last weekend and Lille winning two of dia first three matches for di French Ligue One, and holding currentl Champions League winners PSG to 2-2 draw.
Sabi pipo say di match go be ogbonge mind battle betwin a very experienced coach, Manuel Pellegrini of Betis, and Davide Ancelloti of Lille, son of di legend Carlo Ancelloti wey don work wit im papa for many years dey gada experience.
AEK Athens vs LASK - 5:45 PM
Dis match na battle of di champions.
AEK Athens na di champions of di Super League Greece, while LASK na di current champions of di Austrian Bundesliga.
LASK show say dem be strong team afta dem comot Scotish champions Celtic for di qualification round of di Champions league, beating dem 5-1, and AEK Athens also record comfortable 4-0 win against Leviski Sofia to make am to di league phase of di UCL.
Sabi pipo tok say dis fit be interesting encounter.
Who be di favourites?

Wia dis foto come from, Getty Images
We ask football experts Julien Laurens and Guillem Balague who dem tink say fit win di Champions League dis season, and we also check out wetin di statistics tok. And you can vote for who you think will be crowned champions below.
Julien Laurens:
If PSG do am three times back-to-back, e go be incredible achievement. I no tink say dem fit do am. I tink say di two in a row wey dem do na already special somtin - three in a row dey impossible unless you grt Cristiano Ronaldo for your team, wich dem no get.
I tink say dem go come close. I tink dem fit reach at least semi-final, but I going for three in a row go dey tough.
I no believe fully for di Jose Mourinho-Real Madrid project, so I go rada chose Bayern Munich and Arsenal to reach di final.
To win am, I go say Arsenal. Dem get di best defence for Europe by far and dat na wetin go win titles for you.
Guillem Balague:
As PSG take start di season, we don see say e dey difficult to maintain di level. Luis Enrique dey continue to push im team to dey for di top of football and e dey demanding. I expect dem to get very close to winning am again.
But Barcelona dey fly. Dem go like to get anoda centre-back and a number nine. Na wetin Hansi Flick bin want to get to di next level but he feel say dem fit dey on fia way to the top anyway.
Arsenal don also find a way to win regularly, and dia players feel release wey go make dem play better.
Dose three suppose dey for di semis unless dem first meet bifor. Di fourth team fit be Bayern Munich, Real Madrid or Manchester City.
Wetin statistics say?
According to Opta, last year runners-up Arsenal na di overall favourites to win di Champions League (20.4%), followed by Bayern Munich, wey bin lose to PSG for di semi-finals (20%).
Manchester City dey third wit 12.7%, and PSG come fourth wit 7.3%.
All di five Premier League clubs for di competition dey inside di top 10 for overall win probability and all of dem get more dan 50% chance to reach di last-16.






