History of foldable smartphones as Apple totori pipo wit Iphone 18 series

New Apple oga dey hold di new iPhone Fold wey dem dey plan release

Wia dis foto come from, Karl Mondon / AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, New Apple oga, John Ternus don wash im CEO takeova wit new foldable iPhone
Published
Read am in 4 mins

Apple don drop dia most expensive phone eva as e enta di market wit di first major iPhone design change in almost 20 years, di foldable hand phone.

Di phone wey dem call iPhone Duo na di gamble from Apple new oga John Ternus wey collect work from long time boss, Tim Cook dis month.

Apple dey enta dis market of foldable smart phones late wen you compare am to phone companies like Samsung or Huawei.

But Ternus no gree o, e tell audience for Apple headquarters say dem dey rearrange wetin be di experience of using foldable phones as im yab im competitors say, "odas don create foldables wey be like say dem join-join two phones togeda anyhow".

For di US, di prices dey from within $1,999 to $3,200.

Dis phone na sometin wey Ternus hand dey inside directly afta e bin bin dey work as top executive for Apple hardware division for year.

Di way e look wen you unfold am na like small iPad but e dey wider dan normal iPhone wen you fold am.

Ternus explain di look wen e tok say, "e dey fully new and at same time look very familiar. Na like dis size of your passport, e feel familiar to hold and comfortable to use wit one hand."

Dis change fit be Apple ansa to di yab wey dem dey collect say dem neva do any major product hit or very exciting innovation since dem comot wit di first iPhone for 2007.

Apple bin also reveal on Wednesday say dem dey also release di new iPhone 18 Pro and 18 Pro Max wey for di US go cost starting from $1,199 and $1,299.

Bifor di highest amount wey iPhone wey just comot dey sell for na $900.

How Foldable Smart Phones come about

Huawei phone

Wia dis foto come from, Long Wei/VCG via Getty Images

Wetin we call dis foto, Many foldable phones don dey for market

But many sabi pipo don dey worry ova di new move to foldables given dat oda phones don enta di market and as e cost so e go make am.

See ehn, dis market of foldable phones don comot wit plenti wahala of which na Samsung get most of dem.

Even though di tok-tok around foldable smart phones bin dey since 2013, na for 2018 we start to dey see di fruits of dat labour.

Dis na as Samsung na di first major phone line to comot wit dia foldables for November 2018.

Dem no howeva be di first to unveil of all time, one start up wey dme dey call Royole bin unveil dia foldable phone one week bifor Samsung.

Howeva, Samsung still try make am to market by April of 2019, but e come wit problems.

Many phone reviewers bin call out di brand say dia screen bin break afta few days of use, but as Samsung collect back di phone wey dem give BBC reviewers so dem bin no see di wahala wit di broken screen.

Samsung bin say dem bin get some reports and dey work on finding out wetin cause di mata.

Na so dem push di selling date to September to solve dia first wahala from di first Galaxy Fold.

Even sef some pipo bin get wahala wit di selfie camera wey dem carry put for inside di wider display of di phone living nothing for pipo wey wan use phone selfie.

Chinese brand Huawei also shift dia lauch date for 2019 to September so dem go fit to do more tests afta di Samsung Galaxy fold wahala.

For 2020, Samung introduce di Galaxy Z Flip wey fit close to half of di phone no be double.

Howeva users find am and Motorola Razr wey also enta di foldables business to get wahala wit screens wey dey quick to spoil.

By 2021, BBC technology reprter, Chris Fox tok say di Galaxy Z Fold2 make di first foldable wey enta market to resemble expensive prototype "wey may be be why pipo say e no always be good idea to be early adopter".

Dis na as dem change di material wey dey make d phone fold from iron and even put extra selfie camera for di phone front wen e dey folded.

Dem bin also introduce flex mode wey mean say say you fit split di phone halves in two for some apps like YouTube.

By 2022, Samsung release di eva foldable phone wit dia Flip three wey starting price bin dey under $1000.

As at right now, di phone companies wey dey market for foldables include Samsung, Google Pixel, Huawei, Xiaomi, Motorola Razr, and OPPO.