Mali gbab sojas wey dem accuse say work wit insurgents to plan coordinated attacks

Mali junta leader Assimi Goita

Wia dis foto come from, PAVEL BEDNYAKOV/POOL/AFP via Getty Images

Read am in 3 mins

Di public prosecutor of one military court for Mali capital Bamako say one group of sojas don chop arrest in connection wit di recent large-scale coordinated attacks by jihadists and separatists for di kontri.

Inside one statement wey di prosecutor office read for television on Friday night, dem say one investigation find sojas complicit in planning, coordinating, and executing di attacks. Some of di sojas still dey for service.

Mali defence minister kpai for di violence, wey be di deadliest in ova ten years. Di insurgents tok say dem intend to lay siege on Bamako, and reports indicate say dem don set up checkpoints around di capital.

Among di five military personnel immediately identified na one sergeant, one warrant officer, one chief warrant officer and one retired soja. One dismissed soja named Alassane Diallo aka Abedi kpai during di during clashes for Kati, di statement tok.

Meanwhile, investigators say some politicians bin also play role for di assault, and dem name Dr Oumar Mariko wey be ogbonge opposition figure wey dey live for exile.

Dr. Mariko bin recently make headlines afta reports emerge say e bin meet wit militants of di Al-Qaeda-linked jihadist group JNIM, to negotiate di release of hostages.

"Di first arrests don dey successfully carried out, and we dey seek all oda perpetrators, co perpetrators, and accomplices," di statement read in part, and add say further investigations go dey conducted.

Di arrests dey come amid calls by jihadists for a common front to comot military regime and create new transitional administration.