State Police go be di solution to Nigeria insecurity wahala?

Cross section of senior officers of di Nigeria police wearing their kaki uniforms and blue baret and giving salute

Wia dis foto come from, Police NG/X

Published
Read am in 5 mins

Di move to set up State Police system for Nigeria don dey gada ginger among Nigerians and di way di process dey go, di bill to set am up fit bicom law in a matter of weeks.

Already, tori be say all di Speakers of di 36 State House of Assembly for Nigeria don endorse di deal, wey suggest say wen di bill officially come bifor di State assemblies, e go receive fast passage.

However, di debate kontinu to dey go on about weda true-true State Police na di silver bullet wey di Nigeria govment go take kpai di rising insecurity for di kontri.

Garba Maidoki, di lawmaker wey dey represent Kebbi South Senatorial district for di Nigeria Senate tok say e no believe say State Police go be di solution to insecurity for Nigeria.

Maidoki tok say if di authorities implement fully di laws wey Nigeria get currently, e go address di insecurity issue, "but wen di laws wey dey ground neva dey fully implemented, how you wan believe say na to bring new law be di solution".

"I no believe in di bill wey President Tinubu bring. I no believe say e go work. I no believe say e go fix our security situation," Maidoki tok for interview wit Channels TV.

First, di senator tok say dem get di draft State Police Bill less dan 24 hours bifor di day wey dem suppose vote on am, and di document dey more dan 140 pages, wich mean say dem no get di time to study am well.

Also, Maidoki question di timing of di presentation of di bill.

"If di President really wan fight dis (insecurity) tin, why e leave am until di year of election?... We don dey in (office) for three years, we dey cry we dey complain, and now wey you get less dan one year, you wan change di constitution, implement di bill and make Nigeria safe? E dey very suspicious," Maidoki tok.

For ogbonge human rights lawyer and Senior Advocate of Nigeria, Femi Falana, to solve di insecurity problem for Nigeria dey more dan just putting State Police in place.

Apart from di fear say govnors go abuse am and use am for dia personal and political interests, Falana tok say di root cause of insecurity na poverty.

"Weda you set up State Police today or next year, e get issues wey neva dey addressed," Falana tok for anoda TV interview. "And dat na why some pipo beliv say dis (new push for State Police) na part of di 2027 agenda."

"We dey usually reduce di tok of insecurity to di lack of security infrastructure... witout considering social security.

"Why e be say more young men and women dey take to criminality? Why we no dey tok about creating employment for young pipo? Why we no dey give assistance to Nigerians wey dey vulnerable, extremely poor or dimensionally poor?

"And unless you address dis issues holistically, creating State Police or Local Govment Police no go address di issue of insecurity for di kontri," Falana tok

Human Rights Lawyer Femi Falana carries placard during peaceful protest over insecurity on December 17, 2025

Wia dis foto come from, Adekunle Ajayi/NurPhoto via Getty Images

Wetin we call dis foto, Senior lawyer, Femi Falana say e no dey against creation of State Police, but no be am be solution to rising insecurity for Nigeria.

Anoda sabi pesin for security mata, a former commissioner of police for Anambra State, Aderemi Adeoye, tok say to create State Police na di right step for di right direction, but e no go be di final solution to insecurity.

Adeoye say creation of State Police go mean more officers on ground to prevent crime, so e go make di rate of committing crime to drop.

However, more need to be done, like to "overhaul di existing training curriculum (of police officers) to now include training on emotional intelligence, data analysis, digital literacy, human rights law, so dat di police for di State level no go dey see diasef as anoda occupation force, (rada) dem go dey see diasef as agents of peace and problem solvers to di communities dem dey serve.

How Nigerians dey react ontop social media

Former Anambra State govnor and presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress for di 2027 election, Peter Obi, write on X say: "Going by wetin Nigerians don see so far, e no get guarantee say dis administration go fit resist di temptation to take advantage of state policing to influence di 2027 general election."

Obi tok say e dey necessary make di govment defer di implementation of di State Police system until afta di election.

Anoda X user wit di username Dr Toks, tok say as a federation, e no be must say evri State must to get State Police.

"Let di States wey wan create am do as dem want. Wen dem pass di law, you fit tell your house of assembly make dem no domesticate am," e tok.

Toks giv example wit di recent electricity law wey di national assembly recently amend to give State govments power to generate, transmit, and distribute dia own electricity.

Yet anoda X user wey im username na simply Onyeka, tok say "State police for kontri like Nigeria na recipe for complete, unmitigated disaster."