Senagal, Morocco, Cameroon, and oda countries wey qualify for 2027 Afcon

The host countries are still participating in the qualifiers because they need to stay fit and for group distribution purposes
Wetin we call dis foto, Top two teams for di 12 groups dey qualify, but di groups wey get di three host kontris (Kenya, Tanzania and Uganda), only di team wey finish top spot go qualify
Published
Read am in 3 mins

Di fourth round of di 2027 Afcon qualifiers don end, as teams dey prepare for di last two games.

Some ogbonge teams don qualify, while odas still dey wait for di last two games bifor dem fit confam dia qualification.

Already some teams don comot di qualification, dem no fit make am even if dem win dia last two games.

Di tournament go happun from 19 June – 17 July 2027.

Three countries dey host di competition next year – Kenya, Tanzania and Uganda, wit 24 teams.

But in all, 48 teams dey fight for dis 24 spots across 12 groups.

Teams wey don qualify

  • Morocco – dem qualify afta four wins from four games for dia qualifiers from Group A. di result of dia last two games no go matter.
  • Senegal – di disputed 2025 Afcon winners don qualify for dia Group J. Dem get 10 points from four games wey seal dia qualification. Mozambique, Ethiopia and Sudan go battle for second spot to stand chance to qualify.
  • Cameroon – di indomitable lions don qualify wit 10 points from four games. For Group G, Comoros, Namibia and Congo go hustle ova who go finish second and qualify. Both Comoros and Namibia get three points from four games.
  • Burkina Faso & Benin – For Group F, two teams don already qualify afta four games. Burkina Faso and Benin get 10 points each afta three wins and one draw each. for dia group, Mauritania (3 points) and Central African Republic (zero points) don suffer elimination.
  • Mali – for group K, Mali don qualify afta four games. Dem get perfect 12 points wit two games to spare. Rwanda, Liberia and Cape Verde go battle for dat group for di second position to qualify for di 2027 Pamoja showpiece.
Ghana failed to qualify for the last afcon
Wetin we call dis foto, Ghana and Nigeria dey at risk, dem gatz win dia final two games and hope say oda results for dia respective groups go favour dem
  • Kenya, Tanzania and Uganda – di host kontris for di tournament don automatically qualify for di competition. According to Caf rules, dis host kontris still gatz play for di qualifiers to prepare and keep dia fitness ahead of di tournament. Sake of dis, dia groups (Group D, H and L) wey get dis three kontris, only one team – di one wey top di groups gatz qualify for di tournament.

For group D – South Africa (10 points) and Guinea (9 points) go battle for top spot wey go qualify. Co-host Kenya dey dis group.

For Group H – Libya (5 points), Botswana (4 points) and Tunisia (3 points) all go battle for top spot to qualify. Co-host Uganda dey dis group.

For Group L – dis na di group wey get Nigeria and co-host Tanzania. Currently Guinea-Bissau bin dey lead di table wit 10 points, Nigeria get 7 points. Madagascar already dey eliminated for dis group. Now di top spot na straight fight between Guinea-Bissau and Nigeria, di last two qualifiers go show who go qualify.

Teams wey dey eliminated

  • Madagascar
  • Somalia
  • South Sudan
  • Mauritania
  • Central African Republic
  • Eritrea

Di next round of games go happun 24 March 2027 for match day five and di final match day games go happun between 22 – 30 March 2027.