Nigeria move up for latest Henley Passport Index ranking - Top passports in 2026

Wia dis foto come from, Osarieme Eweka/Getty Images
Nigeria passport don move to 89th spot for di latest Henley Passport Index ranking wey dem release.
Nigeria dey below fellow African kontris like Niger, Mali, Gabon, Cameroon, Egypt, Liberia, Chad and even Burkina Faso.
Inside dis latest report wey Henley release, Nigeria move from 94 place for 2025 to 89 - dat na about five spot up.
Di highest wey Nigeria don go for di passport index ranking na 62 position for 2006 and di lowest position na 103 for 2021.
Also, di report mention say Nigeria passport only get visa free access to 44 kontris for di world while some require visa on arrival.
Visa-free mean say you no need any visa to enta di destination but visa on arrival go require make you receive your visa for di kontri wey you dey go.
Henely Passport Index dey rank all 199 passports based on dia final global access scores and passports wey get di same total score go get same rank.
Di index use di data by di International Air Transport Association (IATA) to rank 199 passports based on dia strength to travel to 227 kontris without visa.
End of Di one wey oda users dey read well well
Singapore, Japan and South Korea na di top three kontris wey get di most powerful passport for di world.
Japan, UAE and South Korea fit get visa free access to 187 kontris of di world, while Singapore fit get access to 192 destinations.
On di oda hand, Iraq, Syria and Afghanistan na di lowest ranked kontris. Afghanistan dey 101 position wit access to only 23 kontris.
Seychelles and Mauritius na di highest ranked African kontris as dem siddown for 22 and 25 position respectively.
Ethiopia, Zambia, Zimbabwe, Lesotho, Somalia, Mauritania and São Tomé and Príncipe, among odas move Nigeria to "visa required" category in recent years- na why Nigeria drop to 44 kontris wit free visa.
According to di Henley Passport, United Kingdom rank 6th place wit access to 183 kontris visa-free.
Canada and Australia dey 7th position wit access to 182 kontris visa-free.
Na Iceland and United States dey 10th wit access to 179 kontris visa-free.
For fourth position na Belgium, Denmark, Finland, Germany, France, Ireland, Italy, Luxembourg, Norway, Netherlands, Switzerland wey get access to 185 kontris visa free.
Kontris wit di strongest passports in di world

Wia dis foto come from, Getty Images/Riska
- Singapore - 1st
- Japan - 2nd
- South Korea - 2nd
- United Arab Emirates - 2nd
- Sweden - 3rd
- Belgium - 4th
- Denmark - 4th
- Finland - 4th
- France - 4th
- Germany - 4th
- Ireland - 4th
- Italy - 4th
- Luxembourg - 4th
- Netherlands - 4th
- Norway - 4th
- Spain - 4th
- Switzerland - 4th
- Austria - 5th
- Greece - 5th
- Malta - 5th
Kontris wit di weakest passports in di world
Palestine dey 94th position wit 38 access to kontris, Bangladesh dey 95 position wit access to 36 kontris.
North Korea dey 96 position wit 35 access to kontris, Somalia dey 97 position wit 32 visa free access, Pakistan dey 98 position wit access to 31 kontris.
Yemen dey 98 position wit visa free access to 31 kontris, Iraq dey 99 position wit visa free access to 29 kontris, Syria dey 100 position wit visa free access to 26 kontris as Afghanistan carry last wit visa free access to 23 kontris.
Palestinian Territory - 94th
Bangladesh - 95th
Nepal - 96th
North Korea - 96th
Somalia- 97th
Pakistan - 98th
Yemen - 98th
Iraq - 99th
Syria - 100th
Afghanistan - 101st
Top 10 strongest Africa passports
Seychelles
Mauritius
South Africa
Botswana
Namibia
Lesotho
eSwatini
Kenya
The Gambia
Tanzania













