Twins brothers marry identical twin sisters for ogbonge Nigerian joint wedding

Twin brothers Kehinde and Taiwo Oguntoye carry Kehinde and Taiwo Adediran. Both couples wear red traditional formalwear.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

    • Author, Makuochi Okafor
    • Reporting from, Lagos
  • Published
  • Read am in 4 mins

Wen guests gada for one church for di southwest Nigerian city of Ibadan for weeked, dem sabi say na ogbonge somtin dem dey see.

Twins brothers - Taiwo and Kehinde Oguntoye - bin dey marry twin sisters Taiwo and Kehinde Adediran for joint ceremony.

Even though di Yoruba pipo, wey full for southwest Nigeria dey well known say dem sabi born twins, no be evri day we dey see twins dey marry demsefs.

Taiwo Oguntoye bin tell BBC News Yoruba on im wedding day say, "We sabi plenti twins, but dis wedding be like say na God run am for us. We bin always dream say we go marry twins."

E add say, "By God's grace, we dey pray say we go born twins for our first and second children. Na wetin our heart want."

The couples pose for a photo. The brides wear identical white dresses while the grooms wear matching suits and bow ties.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Di brothers na fraternal twins, while di sisters na identical twins

Di Oguntoye-Adediran love story start about ten years ago wen all of dem bin dey go school for di University of Ibadan.

Di tori be say one lecturer bin gist di Oguntoye twins say dem sabi one twin sisters wey dem go like meet and dem gree.

Taiwo Oguntoye tok say, "No be like say we neva meet oda twin sisters bifor. We bin date some but sometimes tins no dey work out."

Di Adediran twin sisters bin no really wan meet bifor and no even answer di lecturer calls but las-las dem kon agree.

Taiwo Oguntoye wey now dey in im early 40s remember say, "las-las we go see dem, we tok and dem bin no want relationship dat time".

Instead, di four of dem start to be friends but life shift dem far.

Di sisters wey bin dey study for dia masters for Ibadan go abroad to continue dia studies while di brothers sef travel go different kontris wey include di US and South Africa to work.

Twin sisters Taiwo and Kehinde Oketikun pose for a photograph with twin sisters Taiwo and Kehinde Adisa. All four wear matching multi-coloured outfits.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wetin we call dis foto, Plenti oda twins attend di wedding

Years later, di brothers kon contact di sisters again.

Afta a while, afta initial gra-gra, dia connections kon deep well-wel.

Di couple families happy well-well wit dia relationships, Taiwo Oguntoye remember say e click wit im in-laws instanta.

E tok say, "Evribodi bin dey happy to see us. E bi like say we don know dem since we small. Dem treat us like say we be sons for our papa house."

Di family show style for di wedding, even as di couple do to match for dia clothes.

Many oda twins sef bin attend di wedding. Dis fit no dey shocking as di grooms dey popular wit promoting twins culture. Dem dey call dem di Oguntoye Twins and dem dey active well-well for culture and tourism.

The grooms and brides dance during their wedding ceremony. A man wearing sunglasses wipes one of the groom's brow with a white cloth.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Di brothers na fraternal twins, while di sisters na identical twins.

Kehinde Oguntoye tok say, "Our wives resemble sotey even for our family pipo dey confuse dem sometimes. But no be so wit us, we sabi our own wives, well-well."

Di brodas say dem resemble in terms of personality as dem call demsefs ambiverts - sometimes quiet, sometimes outgoing, depending on di situation.

Taiwo Oguntoye say even though dem dey veri close, dem go live apart as couples.

"We get our own plans for dat, na later pipo go get to know about am."

For now, di newly married couples dey jolly di new chapter of dia love tori wey bin start well bifor life match am break for years and den kon grow to two of di area most popular marriages.

Additional reporting John Alabi of BBC News Yoruba