Global Microsoft outage dey affect tens of thousands of users

Wia dis foto come from, MANAN VATSYAYANA / AFP via Getty Images
Microsoft dey struggle to fix one ogbonge global outage of dia service wey tori be say dey affect tens of thousands of users.
Services like Teams, Outlook and Microsoft artificial intelligence software Copilot don enta one chance on top "connectivity problems".
Di company tok for plenti uptdates on top X (former Twitter) say dem don dey see "positive results" wit dia work for restore di services and say dem dey rush to fix di problem.
Tori of wahala wit Outlook round di world reach climax of at least 140,000 by 18:00 GMT on Thursday, according to monitoring website Downdetector.
Di BBC understand say as at now dia be no proof say na cyber-attack cause di outage.
Which Microsoft services dey affected
Di kasala affect programs say dem dey part of Microsoft 365 wey be popular online services wey business dey use wey inside get tools for work like Outlook, Teams and OneDrive.
For international organisations, dis wahala enta gear two bicos na dis platform co-workers for around di world dey use collabo.
Microsoft say part of di issue na say users no fit find files or details for dia calendar app.
Dia AI platform, Copilot fit no dey work well.
Howeva di company add say messaging and online meetings still dey work.
Microsoft tok for X say di reason for di outage bin dey caused bicos some servers "bicom unexpectedly unavailable", wey put strain for di remaining systems.
"We dey appreciate our customers patience as we dey work to bring back services as soon as possible," na wetin Microsoft tok-tok pesin tok.
Di company later warn say some services wey dem don restore "fit stop to work again", add say customers "for any region" fit dey affected.
Users around di world including US, Japan and Singapore don report say dem dey face disruptions.
Wetin cause Microsoft outage?

Wia dis foto come from, Getty Images
Microsoft don tok say no be cyber-attack cause am, dem say na "elevated load" for dia infrastructure cause di ongoing outage.
Wetin e mean be say wen servers dey handle higher volume of stress pass wetin dem normally dey do.
For dis Microsoft outage case, plenti servers become "unexpectedly unavailable", di company tok, wey come send added traffic go di remaining servers, wey strain dem.
On Friday morning, Microsoft tok say dem don observe "marginal success" for dia efforts to handle di incident.
Di company tok for im latest update say e dey continue to monitor activity across regions to evaluate server status and determine wetin e fit do to improve capacity.
For earlier statement, di tech giant don talk say im attempted fixes "no dey work as expected".
Australian cyber-security sabi pesin, Troy Hunt tell BBC say di outage fit get far-reaching consequences.
"Microsoft na massive part of di internet backbone and e dey remind us how critical email still be.
"Not only di outage dey affect many people ability to work but also things like di ability to communicate about appointments, purchase tins wey need verification, create or access accounts and services," e talk.
Paul Spain from New Zealand-based advisory firm Gorilla Technology tok say wit e-mails and services offline, companies don practically "lost a business day", wey dey "frustrate" users.
AI companies dey feel am
Di outage don hit oda companies too, including AI giants Anthropic and OpenAI, wey dey work with Microsoft systems.
ChatGPT-maker OpenAI tok say e dey investigate issue wey dey affect im connection to Microsoft services, wey don cause some tools to no work as dem suppose.
Microsoft last month report outage of im Azure cloud platform wey affect di tech giant suite of productivity tools and companies worldwide.
Electric truck maker Workhorse Group, wey suppose report third-quarter results on 12 November, don shift am go 16 November, say na business disruptions wey di global Microsoft outage cause am.




















