Zimbabwe issue arrest warrant give Robert Mugabe son for missing court date

Wia dis foto come from, Gallo Images via Getty Images
- Author, Basillioh Rukanga
- Published
- Read am in 3 mins
Zimbabwean court don isues arrest warrant for Bellarmine Chatunga Mugabe, di youngest son of di kontri presido late Robert Mugabe, afta im no show for di appear court.
Dem arrest Mugabe earlier dis month alongside four odas ova assault allegations on a police officer during investigation into suspected smuggling of luxury vehicles.
Di group subsequently face charges of robbery and malicious damage to property. Dem neva enta plea.
Dem grant bail on 6 November and dey due back in court on Tuesday. Howeva, Mugabe fail to show. Di co-accused, im aide and three security guards appear and dey remanded until 10 December.
Prosecutors allege dat Mugabe and di odas assault one investigating officer using dia hands and broomsticks.
Di officer phone dey allegedly taken and smashed on di ground, while one of di accused seize di officer loaded pistol.
Bellarmine Chatunga na di youngest son of Robert Mugabe and im second wife Grace Mugabe.
Robert Mugabe bin rule di kontri for 37 years bifor e dey forced from power for 2017, aged 93, following military intervention. im die for 2019.
Di son don tok for public for recent years ova plenti legal troubles and im high profile lifestyle.
Na last month, e admit to drug related charges involving di possession of cannabis.
For April, dem deport am from neigbouring South Africa afta pleading guilty to pointing firearm and dey di kontri illegally.
Dem arrest am sake of di shooting of 23 years old man for im home.
For 2023, dem arrest am in Harare, Zimbabwe capital, ova allegation dat e damage property and spit for police officer during party.
Dem later free am afta e reach out of court settlement wit di complainant, wey be im friend.



















