Five key points from Trump UN General Assembly speech

Trump speaking for di United Nations General Assembly

Wia dis foto come from, Reuters

Published
Read am in 5 mins

United States President Donald Trump don deliva ogbonge speech for di ongoing United Nations General Assembly (UNGA).

Trump tok about plenti tins from di Russia-Ukraine war to di issue of Artificial Intelligence, and den about di ongoing crisis betwin di US and Iran.

E open im speech wit di US economy, di employment and poverty rate, cutting regulation and taxes, di stock market as well as border security.

Trump maintain say di US na leader for virtually evritin and di future dey veri bright.

Hia na some of di highlights of Trump speech for di 81 UN General Assembly:

'Make I destroy Iran abi make I negotiate?'

Official of Iran listening to Donald Trump speech at di United Nations General Assembly 2026

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Iranian official dey listen as Trump say America fit totally destroy di Islamic Republic

On Iran, Trump say im dey struggle to decide weda to totally destroy Iran abi make im kontinue to dey negotiate wit di kontri, but wetin sure for am be say "Iran no go eva get nuclear weapon".

"Will deal be made wit Iran wey go make dem create greater kontri dan dem eva be bifor... abi make I end di Islamic Republic, and do am quickly neva giving dem chance to kill and destroy pipo and kontris again?" Trump ask.

"Abi make I drive dem into hell wit no chance of survival and no hope of future greatness or generation?

"But I believe say we go make deal right afta di (November US mid-term) elections."

Trump add say im know say Iran officials dey monitor di elections to know how di Republican Party go perform, but dem forget say "I no dey for di ballot".

From AI to SI

President Trump tok say di United States na di clear leader currently for di race to develop Artificial Intelligence, adding say di first kontri wey go get am right, go win.

E condemn di recent criticism and call to regulate AI and e tok say e no like di use of di word 'artificial' bicos e make am sound fake.

"E no be fake, e actually dey amazing. But we gatz dey careful," Trump tok.

Di US President den tok say going forward, all US documents on AI go change to reflect di more correct term - 'Super Intelligence' not 'Artificial Intelligence'.

"Welcome to di new world of super intelligence - SI," e tok.

According to sabi pipo, Super Intelligence na word wey dey exist already, but e mean different tin from wetin Trump tok about.

SI refer to di period for future AI go don dey too good sotey e no go need human intervention at all, and dat na wetin many sabi pipo say dem dey worried about.

Cuba officials waka out as Trump call dia kontri 'failed state'

Melania Trump and oda top US officials clap as Trump dey address di United Nations General Assembly

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di US delegation to di UNGA include Trump wife, Melania and oda top US officials

Officials from Cuba waka comot di hall in protest wen President Trump begin tok about di kontri and call am 'failed State'.

"My administration dey also seek fundamental change for di situation for Cuba, wia di communist regime dey unda great pressure — di biggest pressure dem don eva dey under. Na absolutely failed state," Trump tok.

"E dey fail like neva bifor and e go fall, Marco Rubio dey handle di negotiation wit Cuba, we go see wetin hapun. We no go allow foreign adversaries to threaten America right for our doorsteps."

On di Russia-Ukraine war

Trump tok say di US dey work closely wit di leaders of Russia and Ukraine to negotiate how di war betwin di two kontris go end, and e add say "we go get dat one done, more quickly dan pipo understand".

"25,000 young pipo - mostly sojas - dey die evri month on both sides. and I look at dose battlefield fotos and I no wan see dem any more. E dey so horrible to see." e tok.

Di US President also say since e enta office, e don end eight wars and e and leaders of dose kontris don bicom friends as a result.

E say e use im "special relationships" to negotiate di end of dis wars, including trade, and di threat of tariffs.

Trump name Cambodia and Thailand, Kosovo and Serbia, di Democratic Republic of Congo and Rwanda, Pakistan and India, Armenia and Azerbaijan, and di war on Gaza.

Sabi pipo howeva say di claims by Trump no dey absolutely correct bicos some of dis wars still dey go on till today.

On di ICC

President Trump tok say make all di kontris wey be members of di International Criminal Court (ICC) pull out from di organisation, as e describe am as "evil group of ⁠pipo" and "out of control institution".

"We no go eva allow US military service members or anyone else to dey investigated or give show trial by one anti-American tribunal wey no get jurisdiction ova us," Trump tok.

"I call on all nations wey be members of di ICC to officially ⁠resign from dis rogue institution immediately."

Trump den go ahead to condemn how, according to am, di UN dey overlook all di atrocities wey dey hapun around di world but dem dey always criticise di US for dia positions on issues like transgender, Christian persecution and immigration policies.

Di 81st United Nations General Assembly dey currently go on for di US State of New York and e go last from 21 to 25 September 2026, wit di theme: 'Restoring trust, managing transformation: A United Nations wey go deliva for all'.