Ethiopia and Eritrea cut diplomatic ties as kasala burst between dem

Armed men inside armoured vehicles as dem dey drive through Alamata for Ethiopia
Wetin we call dis foto, More dan 50 pipo don die since di fighting start for northern Ethiopia last week
    • Author, Lucy Fleming
    • Author, BBC Africa
  • Published
  • Read am in 6 mins

Ethiopia and Eritrea cut diplomatic relations as renewed fight for northern Ethiopia dey raise fears of wider regional conflict.

On Thursday, Ethiopia announce say dem dey close dia embassy for Asmara, di capital of Eritrea, and dem order 10 Eritrean diplomats make dem comot di kontri within 48 hours, dem accuse dem say dem dey do tins wey dey threaten national security.

Eritrea respond by cutting diplomatic relation, dem tok say Ethiopia decision don leave dem wit no choice dan to do dia own back.

Di diplomatic confrontation dey come just hours afta powerful explosion wey happun overnight for Addis Ababa, Ethiopia capital, including near di military headquarters of Ethiopia.

E follow sharp deterioration for di relation between di two kontris, as Ethiopia dey accuse Eritrea say dem dey support new rebel alliance – accusation wey Asmara don deny many times.

Eritrea describe di decision to expel dia ambassador as "astounding".

"Eritrea no get option but make dem do dia own back and cut all diplomatic relation wit Ethiopia," dia foreign ministry tok. Dem warn say di decision go get "negative consequences".

Di diplomatic fallout dey come as Ethiopian federal forces dey fight soldiers from Tigray People's Liberation Front (TPLF) and dia allies across parts of di northern regions of Tigray, Afar and Amhara.

Kasala don burst for Ethiopia northern region of Tigray, between regional forces and di national army.

Tigray residents wey just dey recova from di brutal war wey last for two years for 2022 dey fear say anoda one fit happun.

Report tok say pipo dey rush to buy tins - and now internet and call service don scata.

Dis mean say pipo no fit get access to dia money through digital apps for wetin don turn to cashless society since ATMs don stop to dey work for several months.

Why di kasala burst?

E don pass six months wey di relationship between di govment and Tigray People's Liberation Front (TPLF), di party wey dey run Tigray, don worse.

African Union (AU) broker one peace deal wey dem call Pretoria Agreement between di two sides - dis stop di war nearly four years ago - but many issues don remain unresolved wey don cause di tension to rise.

Dis year, both sides dey throw blame as troops don gada for small fight.

Dis week, big kwanta start for Tigray and e don quickly spread go Afar and Amhara regions. Di two sides no gree ova who start di latest kwanta.

TPLF say dem dey respond to federal attack, wey include drone strikes, while govment tok say Tigrayan forces attack first afta dem seize control of airports for Tigray.

Who be TPLF?

For Tigray modern political history, na TPLF dey govern dem, dem first start as armed movement for di1970s Ethiopia military govment.

Dem become strong force in di overthrown Marxist regime for 1991, and dem become di most powerful for Ethiopian People's Revolutionary Democratic Front (EPRDF), di group dey rule di ethnically diverse kontri for almost thirty years.

Some pipo dey feel say TPLF dey hold too much power becos Tigrayans only make up about 6% of Ethiopia population.

Wen Abiy Ahmed become di prime minister for 2018, e change EPRDF wit di Prosperity Party, wey reduce TPLF influence.

Di relationship wey dey between Addis Ababa and TPLF reduce until war break out for 2020, wey be one of di deadliest conflicts for dis century.

AU mediator tok say about 600,000 pipo die for di war, wey completely cut Tigray off from di outside world and carry di region near famine level.

Dem agree uneasy truce for November 2022.

Why di peace deal no work?

Di key four main issues - and two concern di fertile area for western Tigray.

Di TPLF lose control of dis territory for di early days of di war to Amhara, wey be region wey dey near Tigray for di west and dia fighters don dey fight for di side of Ethiopian army.

Many pipo for Amhara believe say dis western Tigray area suppose no even join Tigray wen dem redraw boundaries afta dem remove military regime for 1991.

Wen di fighters collect control during di recent civil war, hundreds of thousands ethnic Tigrayan pipo run comot and now dey live for homeless camps for Tigray and di capital, Addis Ababa.

TPLF wan get western Tigray backing and pipo wey don run comot from di territory return. Di govment say di future of di territory suppose dey decided by referendum.

Pipo dey for market for Mekelle, Tigray - September 2026

Who dey back di TPLF?

Major change happun as TPLF wey dey for Ethiopia gain many key allies.

For early September, dem join six oda armed groups wey form wetin dem call Alliance for Survival, wey include pipo wey dey fight govment like Amhara's Fano militia and di Oromo Liberation Army.

Members of dis new alliance get different grievance, but dem get one goal: dem wan remove Abiy govment from power.

BBC map of Ethiopia dey show di northern states of Tigray, Amhara and Afar. Di regional capital Mekelle dey for Tigray and di national capital Addis Ababa dey near di center of di country just outside di three northern states. Eritrea dey north, e dey border di Red Sea, and small map dey show di region wey dem dey call di Horn of Africa.

So while TPLF and Fano forces dey on different sides during di civil war - and dem still no gree ova wetin go happun for western Tigray - dem don put some of dia differences for one side for now.

TPLF officials tok say dem no wan make wetin happun for 2020 happun again, wen dem dey feel like dem dey surrounded and alone.

But analysts dey warn say dis alliance fit dey hard to keep becos di members get different interests.

Wetin be di govment position?

As dem dey blame TPLF say na dem start di recent kwanta, TPLF too dey criticise di new alliance and say e be like dem wan scata di kontri.

Dem also accuse Eritrea of supporting armed groups for inside Ethiopia, but Asmara deny am.

During one recent civil war, Eritrea fight alongside Ethiopian soldiers, but di two neighbours wey get volatile relationship don fall out again.

Dia disagreement centre on di Red Sea and dia ports.

Ethiopia na di world most populated landlocked nation - dem lose access to di ports wen Eritrea agree to separate for 1993. Recently, Prime Minister Abiy don dey push to take ova Eritrea southern port of Assab - wey dey about 60km (37 miles) from di border - and dem don give hint say dem go take am by force.

Wetin dem dey do to stop di fighting?

Wetin we call dis Video, Tigray capital "no get cash" as di kwanta burst out

Na AU dey lead di main diplomatic effort and dem don call for immediate end to di fight and say make both parties return to direct tok-tok.

Dem don ask former Nigeria President Olusegun Obasanjo, wey be di AU special envoy for Horn of Africa, to engage di parties sharp-sharp.

Di UN don make similar appeal as dem dey warn say wider and more serious conflict fit happun.

Di regional organisation Igad don also urge di parties say make dem stop to dey fight but start to dey dialogue.

Di wahala be say di trust wey dey between Addis Ababa and Tigray don dey extremely low, as di new armed alliance don make di mata more complicated.