Wetin dey ginger men to get penis fillers, despite di risk?

Black male athlete wearing boxers

Wia dis foto come from, Getty Images/PeopleImages

Published
Read am in 4 mins

Penis fillers, wey dem design to increase di organ size don dey gain popularity, despite warnings say e get complications.

Some men don land for hospital wit penis wey dey turn black and di skin "dey peel off" afta botched procedure.

Di British Association of Urological Surgeons don issue warnings give men wey dey get these procedures.

Recently, tori bin spread say one Nigerian British social media influencer Igho Ubiribo, wey im alias na "Tiny", "Denisi" and "Ego die, afta e allegedly undergo one penis enlargement procedure during holiday for Thailand.

According to tori wey BBC News Pidgin neva fit independently verify, one UK coroner rule say di cosmetic procedure cause fatal pulmonary embolism.

Tori say dem allegedly inject Ubiribo penis wit 40 millilitres of hyaluronic acid and lidocaine for one unnamed clinic for Thailand for March.

Following di surgery, e bin fall sick and doctor say Ubiribo suffer pulmonary embolism and dem recommend CT scan.

Afta im death, dem carry out postmortem examination for UK and dem later discover say di material for Ubiribo lungs dey consistent wit di hyaluronic acid wey dem use for di penis filler.

According to tori, di coroner, Jean Harkin rule say Ubiribo died from pulmonary embolism wey di cosmetic procedure cause.

Pulmonary embolism dey occur wen di blood vessel wey dey supply di lungs block. Di condition fit dey life-threatening becos e fit suddenly restrict blood flow to di lungs and put serious strain on di heart.

Black male athlete wearing boxers

Wia dis foto come from, Getty Images/PeopleImages

One man Jason wey follow BBC tok, say im no want "Coke can" – dat na di nickname for penis wey dem don enlarge wit so much filler, so tey e resemble a stubby drink can.

"Some pipo dey really go really overboard," Jason tell BBC reporter wen dem meet for Manchester.

Im procedure increase di girth of im penis by 16% - an amount im, and im partner, dey really happy wit. E say e give am "self-confidence boost".

"Evritin still dey funtion as normal," Jason explain - just wit "dat extra little bit of width".

Also, 27-year-old Abdul Hasan, na returning customer for penis fillers. Dis time aaround e bin do di procedure as a surprise present for im girlfriend.

E don dey wit her for eight years, but say im no dey sure if e dey please her sexually.

Last time wey e do filler she bin dey "100%" surprised, e tell Victoria Derbyshire programme.

"I reason say 'One more no go pain'.

"E make me happy for some reason," e add.

For Abdul, low self-esteem na anoda reason why e want di 10ml filler.

So why men dey do am and wetin be di risks?

Di equipment dem need, include cannulas and syringe, to perform a penis filler procedure

Wia dis foto come from, BBC/James Gallagher

Different varieties of penis-enhancement options dey. E get surgical and non-surgical techniques and different materials wey dem fit inject into di penis.

Most common by far na di one wey dem go inject on gel-like substance hyaluronic acid - di same key ingredient dem dey use for lip fillers into di soft tissue under di skin of di shaft.

Hyaluronic acid na naturally occurring sugar molecule for di body and e known as a "moisture magnet" as e grab hold of water.

Di process dey start wit consultations on di patient health, reasons why e wan do di procedure, expectations about di results, and discussion about di risks.

On the day of di event itself, dem go inject di penis wit hyaluronic acid three times - on di top and on either side.

Dem dey deliver di hyaluronic acid filler through one cannula wey dey enta di base and travel along di length of di shaft.

Then, dem go massage di filler to make evriwia look di same.

At a cost of up to £3,500, Dr Javed Hussain wey don dey offer penis fillers for more dan one year for im clinic tok say, men fit expect between 10% and 20% more girth for di next six to nine months.

But e get risks. These range from relatively minor ones like soreness, bruising and uneven filler, to serious ones wey include infection.

These risks apply to all procedures wey dey use filler. However, e also get risk of damaging di vital structures and blood vessels for di penis wey dey needed for an erection.

Prof Vaibhav Modgil, one andrologist and consultant urological surgeon for di NHS for Manchester, say im don see wey come di hospital afta botched procedures.

"Wen e happun, e fit dey devastating for di patient," e tok.

E remember some men wey e see wit "skin necrosis, wia one area of di skin don dry off and don turn very black and e be like say e dey shed off.