'My papa cancer don spread' - Hunter Biden
- Author, Shaimaa Khalil
- Role, North America correspondent
- Author, Paddy O’Connell
- Role, BBC Newsnight presenter
- Published
- Read am in 4 mins
Hunter Biden, di son of former US President Joe Biden tok say im papa cancer don spread.
Hunter Biden for one interview wit di BBC bin get emotional as e dey tok about im father health.
Cancer dey really hard," e tok, e stop to clear im throat. "e dey really sad to watch."
E reveal say di "cancer don spread, e don enta im bones and further. E dey very painful" and "very unbearable".
"My dad, to dis day, na di centre of our family," e tok. "E be di best father, di best husband, di best grandfather."
"Di only thing wey I fit tok about my papa, about im health right now, na say I wish say e go complain more."
For di interview, e tell BBC say im na "di most privileged pesin ever" afta e receive presidential pardon from im father.
E acknowledge say di mata no be good choice for America or im father legacy.
End of Di one wey oda users dey read well well
For di wide-ranging interview wit BBC Newsnight, Hunter Biden defend di controversial pardon, e say im father "painful" cancer don spread, e rule out any idea say im wan run for elected office and e tok about im addiction and how e dey help oda pipo to recover from addiction.
Hunter Biden tell BBC say im pardon 'no good' for America or im father legacy
Hunter Biden also tell BBC say im na "di most privileged pesin ever" afta e receive presidential pardon from im father.
E acknowledge say di mata no be good choice for America or im father legacy.
For one wide-ranging interview wit BBC Newsnight, Hunter Biden defend di controversial pardon, e say im father "painful" cancer don spread, e rule out any idea say im wan run for elected office and e tok about im addiction and how e dey help oda pipo to recover from addiction.
Wen BBC ask am about di 2024 pardon, e say im understand di criticism but note say: "Wetin you for reason about my father if e no do am for me."
"Na sometin pipo dey easily criticise and for good reason," e add.
"E no dey fair… All I know na say I dey grateful say e do am for me," e tok, e acknowledge say di pardon "no good" for di American pipo, di Constitution - or im father legacy.
E argue to BBC say im father ultimately act out of concern say im go bicom target under Donald Trump incoming administration.
2024 Presidential debate
Hunter Biden also tok about di June 2024 presidential debate wey ultimately end im father re-election campaign.
E say e watch am from im house for California and immediately im know say something dey wrong.
"I bin shock," e tok. "I know something dey wrong."
Hunter Biden bifor now don argue say im father poor debate performance show physical exhaustion afta extensive travel.
Following Joe Biden cancer diagnosis, e also question weda di sickness fit already dey affect im father.
E say im father remain politically engaged and dey determined to continue to dey tok publicly.
Hunter Biden tok why e fall into addiction
Wen BBC ask am about di depths of im addiction, e describe as e almost drink one gallon of vodka one day as e dey smoke crack cocaine almost evri 15 minutes at di worst.
"Na hell on earth," e tok. "Nothing dey glamorous about am."
E tok why e turn to drugs and alcohol, Hunter Biden reject di suggestion say e feel untouchable bicos e be di son of a president.
"I no dey reach for anytin except oblivion," e tok. E note say im addiction na way to escape feelings of anxiety and isolation.
Di drugs and alcohol initially bin feel like solution bifor e bicom "di thing wey almost kill me", e tok.
Hunter Biden bin get emotional at times for di interview, notably wen e dey discuss im father health.
Wen tori pipo ask am about rumours say e fit enta politics - or even make a run for di presidency - Biden say im "no get interest in elected politics" and dismiss any suggestion say im go one day seek office.
Instead, Biden say im wan devote im time to speaking about addiction and recovery, wey e describe as a cause capable of bridging America political divides.
"I believe say addiction plus di hope of recovery na sometin wey connect us all," e tok.
Wen dem ask am wetin e dey proud of im father di most, Hunter Biden point no be only to im years in public office but to im resilience.
"I dey most proud of im resilience," e tok. "E don prove time and time again say wen you get knocked down, you fit get up.
"E be di toughest man I know."
















