Wetin be di six conditions wey Iran give Trump to open di Strait of Hormuz?

Wia dis foto come from, Getty Images
Both Iran and Oman don tok say negotiations ova new arrangement ontop how to manage traffic wey dey pass di Strait of Hormuz don dey "positive" and dey advanced stage and e dey lead to hope say shipping traffic go fit start again.
Recently, negotiations don dey focus on possibility of new route through di Strait wey both Iran and Oman go dey responsible for.
But as ginger don rise, Iran don publicly drop list of demands wey dem say US gatz meet bifor dem agree to open di waterway. Many go beyond parts of di US-Iran Memorandum of Understanding (MoU) wey Iran and US bin agree for 17 June while odas dey repeat dia demands but now dey link dem to di opening of di waterway.
So wetin be dis conditions? And US go fit meet dem?

Wia dis foto come from, Getty Images
For statement wey state broadcaster IRIB bin publish, former Iran Secretary of di Supreme National Security Council and current advisor to di Supreme Leader, Mohammad Bagher Zolghadr, bin warn say di United States gatz "correct" dia behaviour and meet list of demands. E say 'behaviour correction' mean say:
1. Neva threaten Iran wit any language or insult di sanctities of dis nation.
Iran tok say di US must stop to dey threaten di kontri and assure dem say dose threats no go happun again. Dis na mainly politician and security demand. Even as ceasefire dey show some restraint from both sides and publicly ask for guarantee from future threats be like broader strategic condition rather dan one wey bin dey inside di one wey dey inside di previous terms of di interim deal.
2. End di war and aggression against Iran and im allies for Lebanon, Palestine, Yemen, and Iraq forever.
Iran dey insist say military action gatz cease and no be only against Iran but also against im allies and partner groups for Lebanon, Palestine, Yemen and Iraq. Di June MoU tok about "All fronts wey include Lebanon", dis one torchlight di oda kontris and effectively wan look for more regional security guarantees.
3. Lift di naval blockade and comot dia forces (naval and air) from around Iran.
Under di June US-Iran MoU, di US suppose don end im blockade within 30 days but e bin no dey directly linked to di reopening of di Strait.
4. Pay full compensation for di damage caused to Iran in two wars of aggression
Dis mean di 12 days war for 2025 plus di most recent war. Compensation mechanisms bin dey expected to dey discussed for di final agreement afta di June MoU. But now Tehran dey publicly link di compensation to di reopening of di Strait of Hormuz.
5. Lift di 'cruel and illegal' sanctions against di Iranian nation.
One timetable for sanctions relief bin dey expected to dey part of di negotiations for final settlement. So Iran no dey try add new issue here. Again, wetin dey new na di insistence say sanction relief dey linked to di reopening of di strait.
6. Unconditionally release di frozen and stolen assets of di Iranian pipo.
Again, dis demand no dey new. Di release of overseas assets wey don dey blocked or frozen don dey discussed bifor.

Wia dis foto come from, Elke Scholiers/Getty Images
Di six conditions dey broaden di terms wey Iran now say must dey met bifor di strait fit dey reopened.
BBC Middle East analyst Sebastian Usher tok say dis one mark Iran wey dey tanda dia request. E tok say "dis be conditions wey don dey around as part of di Memorandum of Understanding framework agreement... but di timing and mechanism fit dey veri different". E tok say Tehran fit feel like na dem get upper hand sake of say, di Strait of Hormuz "still dey basically closed".
But Trita Parsi, wey be di executive vice-president of di Quincy Institute, wey be American foreign policy tink tank tell di BBC World Service Weekend programme say e believe say di Iranians sabi demsefs say dis positions dey exaggerated and say dem dey likely to back down from dem.
E tok say, "wetin dey put forward for di public level no be necessarily wetin go dey shown for negotiating table".

Wia dis foto come from, US Central Command / X
Parsi dey also suggest say dis fit be negotiating tactic: "e fit easily be say dem dey try to long dis process". E tok say dia be belief among di hardline pipo for di regime say Iran bin gree too quick for di MoU for June.
Den di agreement just last for days bifor e scata wit do-me-I-do-you attacks just afta dem sign am.
Parsi tok say some pipo for Iran dey argue say if dem for drag dose negotiations make e long, wey for push oil prices up and cause more global pain, President Trump for no sharparly order strikes against Iranian targets. Apparently no be di kain "mistake" Iran wan make again.
Even wit dis, e still dey predict say agreement ova di Strait of Hormuz fit dey just days away.
Di pipo wey dey wait for ships or dey watch di price of oil dey hope say e dey right.









