Donald Trump life for pictures

Trump and Vance
Published
Read am in 6 mins

Donald Trump don win di US election and go make a historic return to di White House.

Di Republican tell happy crowds for Florida say: "America don give us an unprecedented and powerful mandate".

As Trump and di Republicans dey celebrate im victory, dis na some key moments from im life.

Donald Trump dey make phone call

Dem born Donald John Trump on 14 June 1946 for di New York borough of Queens.

Na im be di fourth of five children, e get two brothers - Fred Jr and Robert - and two sisters, Maryanne and Elizabeth. Elizabeth na im only sibling wey still dey alive.

Im papa Fred run a successful construction company for di outer boroughs of New York.

E join di business for di first time for 1968, but soon go start im own for di heart of Manhattan.

One black and white foto of Donald Trump wit im father Fred for New York against a backdrop of skyscrapers
Donald Trump dey make phone call for im Trump Plaza office for Manhattan for 1987.
Donald Trump pose in front of slot machines for di opening of di Taj Mahal casino for Atlantic City, New Jersey.

Casinos, condominiums, golf courses and hotels follow, from Atlantic City, Chicago and Las Vegas to India, Turkey and di Philippines.

Donald Trump flamboyant style help am stand out for New York business world and e rise to stardom for di entertainment world wit di TV show, The Apprentice.

Donald Trump, wear red shirt and white blazer, stand for one big, grand hallway for im mansion.
Donald Trump dey read newspaper for im helicopter as e dey fly ova di Twin Towers in New York .
A smiling, seated Donald Trump wit im son Donald Trump Jr. and im daughter Ivanka Trump for one publicity shot for di season 6 finale of The Apprentice.

Trump don marry three times and e get five children.

E first tie di knot for 1977 wit Ivana Zelníčková.

Donald and Ivana Trump pose beside di golden banister of dia staircase.
Donald and Melania Trump for di 2005 Vanity Fair Oscar Party for Los Angeles, California.

Trump marry im third wife Melania Knauss for 2005. Wen dem meet seven years earlier, e be 52 and she be 28.

Im political career bin start for 2015 wen e announce im White House bid during one press conference for Trump Tower surrounded by im family.

Im motto: “Make America great again”.

Trump tok for Trump Tower for New York under one blue banner say Make America Great Again. E announce say im go seek di 2016 Republican presidential nomination, as im family watch from di sidelines.
Donald Trump give thumbs up to crowd during one acceptance speech for im election night event for New York.
Hillary Clinton waka comot stage as Donald Trump clap during one debate.

Afta one bitter campaign wey dey marked by controversy, e beat Democratic candidate Hillary Clinton and e dey sworn in as di 45th president of di United States for 2017.

President-elect Donald Trump waka along one blue carpet and many thousands watch am as e arrive for im inauguration ceremony for Washington, DC.
A smiling Trump sit for im Oval Office desk for di White House in front of cameras and TV crews.

Im presidency na uncertain time for US allies, as e often dey clash openly wit foreign leaders.

E withdraw from major climate and trade agreements and e launch one trade war wit China.

Di den-German Chancellor Angela Merkel lean ova one table to follow seated Donald Trump tok during one G7 summit for 2018 for Canada. World leaders wey include Theresa May, UK prime minister, Emmanuel Macron, French president, Shinzo Abe, Japan prime minister, and John Bolton, US national security adviser surround dem.
Theresa May, dressed in red, hold Trump hand as dem walk by White House.

Criticism bin dominate di final year of im presidency ova di way e take handle di Covid pandemic.

Trump bin dey forced to take a break during im 2020 election campaign afta e dey diagnosed wit di virus.

Donald Trump, for one thick, dark overcoat, remove im protective mask on di White House balcony for Washington for October 2020.

Trump lost di 2020 presidential race to Joe Biden but e refuse to accept di result, as e claim say di election dey rigged.

E rally supporters for Washington on 6 January and encourage dem to march to Congress.

Di rally bin turn into riot and im actions on dat day na di focus of two criminal cases.

Donald Trump raise one gloved fist to greet di crowd for one rally on January 06, 2021, for Washington, DC. One member of di crowd dey hold one Stand wit Trump placard.
Explosion wey one police munition cause bin light up di front of di US Capitol building for Washington on 6 January 2021. Trump supporters bin gada for dia.

E be like say im political career bin dey ova, but e announce anoda run for president and quickly become di Republican Party frontrunner.

Trump begin di general election campaign as e face 91 felony charges.

Donald Trump, in navy blazer and red tie, pose for im booking foto for di Fulton County Jail on 24 August, 2023, for Atlanta, Georgia.

For, May 2024, court find am guilty of 34 counts of fraud wey relate to hush money paid to adult-film actor Stormy Daniels ahead of di 2016 election.

Back on di campaign trail ova di summer, one 20-year-old gunman bin try to assassinate am for one rally for Butler, Pennsylvania.

Trump, wit blood across im face, raise im fist as e comot one campaign stage afta dem shoot am. US secret service agents bin surround am. One US flag dey fly for di background.
Donald Trump give thumbs up to di crowd for di Republican National Convention for Milwaukee. E get white bandage on im right ear.

Days later for di Republican National Convention, dem confam am as di party presidential candidate.

A win for Trump make am di US oldest president ever. E go be 82 by di end of im term.

Donald Trump siddon for im office desk for Trump Tower, New York. Di desk dey covered in magazines and papers. Di windowsill for im back dey packed wit awards, trophies and framed fotos.