Police to charge woman wey allegedly use sex toys on daughter on livestream video

Wia dis foto come from, Anulika Onyeanusia/TikTok
Anambra state police command don arrest 36-year-old, Anulika Onyeanusia wey allegedly use sex toys on her daughter.
Di police command arrest Anulika and her husband for Onitsha, Anambra State on Thursday, 10 September.
Tochukwu Ikenga, tok-tok pesin to di state police command tell BBC News Pidgin say dem arrest di woman from her residence afta dem discover di video wey dey trend online.
Ikenga tok say di woman don dey dia custody and she no make any claim say di content na AI content video instead she confess say she dey use sex toy on her daughter during di live video.
E tok say dem go charge di woman to court as soon as dem complete dia investigation and determine di crime wey di woman commit.
"Di woman dey my office and she don confess, I neva hear her tok say na AI content. We dey do all di neccesary tins to charge her to court," Ikenga tok.
"As soon as we end our investigation, we go charge her to court, we just arrest her yesterday.
"She confess say she use sex toy on her daughter inside di video."
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin dey di video?

Wia dis foto come from, Anambra state police command/Facebook
For inside di video wey dey spread for social media, Anulika bin raise her daughter leg up, wia she dey laugh and pipo dey hear di scream and cry of di minor.
Anulika show di viewers di sex toy wey she dey use, as she dey call for donations but BBC News Pidgin no fit ascertain weda truly di sex toy penetrate di minor vagina.
Anulka also show di face of di minor, as her daughter dey cry and scream on di livestream, while she dey smile witout any motherly care towards her pikin.
Netizens for dia reaction to di video, call di action wey di woman dey do to her pikin "evil" and dem call on di state govment to take action.
Anambra state police inside dia statement on Friday morning, tok say dem don arrest Anulika on Thursday evening, based on wetin dem gada from social media ova one "disturbing trending video of one lady wey dey allegedly use sex toys on her minor."
Ikenga tok say dem rescue four pikin between di ages of two-nine from di woman and her husband, and dem recover sex toys and oda sexual related items wey dey relevant to dia investigation.
Ikenga add say dem arrest di woman husband too as e get some kwesions to ansa.
"Di operation also lead to di rescue of four children, age 2, 3, 6 and 9 years respectively, as well as di recovery of sex toys and oda items wey dey relevant to di ongoing investigation.
"Di suspect currently dey for police custody as di command dey intensify dia investigation into di circumstances wey dey surround di alleged offences and di possible involvement of oda pipo wey fit dey involve.
"Di husband of di suspect also dey undergo interrogation to determine weda e get any connection wit di alleged offence," Ikenga explain.
Anambra state commissioner of police, Nnanna Oji describe di action as "unacceptable becos e involve di exploitation and abuse of children wey no fit protect demsefs."
E say make police carry out thorough and professional investigation while dem ensure say di rescued children get appropriate care and protection.
Ikenga don promise say di command go work wit appropriate child-protection and relevant support agencies to ensure say di victim receive di necessary care, protection, counselling and oda support wey she require for her recovery.
"We go protect dia identities and privacy throughout di process, and we go treat dem wit compassion and sensitivity," di statement tok.
"Di command also commend di vigilante operatives for di area, as well as bloggers and residents wey provide information during di investigation wey lead to di arrest of di suspect."












