Senegal 2-2 Belgium World Cup round of 32 extra time live updates

Belgium made changes that affected the game

Wia dis foto come from, FRAN SANTIAGO/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Ismaila Sarr score im fourth goal of di tournament
Published
Read am in 13 mins

First Half Extra Time

98" Freekick to Senegal in front of dia own box afta Belgium try to win di ball.

97" Di Red Devils bin dey pass di ball around to allow Senegal to comot and tackle

96" Freekick to Senegal, goalkeeper Diaw play di ball inside but Belgium get possession now.

95" Di game don calm down now. Nobody dey rush to create chances so far.

Pape Thiaw carry young players enta di game now to try and find di winning goal.

94" Iddrisa Gana Gueye don comot for Ndiaye.

Nicolas Jackson already try to reach one long ball ova di top but di Belgium keeper collect di ball.

93" Di game don restart. At dis point whoever go score again get chance to win am.

Bifor dat, dem bin dey make changes for Senegal. Sadio MANE don dey comot, jakobs also comot. Diouf and Nicolas Jackson don enta.

92" Freekick to Senegal.

Lukaku tink say im win freekick afta dem push am but referee say play on

91" Belgium get possession now, di defenders don dey pass di ball amond diaserf

90" Senegal try to begin di attack early for dis first half extra time.

Di game don resume as extra time start. Which of di teams go find di winning goal.

Second Half

FULLTIME!

90+7" Senegal get throw-in for di left side of di Belgium box.

90+6" Gana Gueye shoot from way outside di box afta some patient passing by Senegal, di ball go wide. Courtois bin cover im pole well.

90+5" Senegal try to create sometin, Mbaye lose possession wey Belgium clear dia lines.

90+4 Senegal try to cfreate one attack for diaserf. Dem reach di box wey dem carry di ball go back to dia midfield., Time bin dey go.

Lukaku try to connect wit one ball, Belgium try to create anoda chance but referee blow whistle for offside

90+3" Freekick to Senegal afta Belgium player block di keeper when im try to play di goalkick.

90+2" Diaw comot to catch one cross to reduce di pressure on Senegal.

Belgium now dey put pressure to find di winning goal. Dem win corner from one counter attack.

+7 mins

87" GOOOAL! Yuri Tielemanns head Belgium equalizer into di net. Di Keeper comot but miss di ball.

85" GOOOOAL! Romelu Lukaku score for Belgium. Munieir bin cross di ball into di box for Lukaku to score im 92nd goal for im kontri

84" OFFSIDE! Referee don blow whistle for offside many seconds afta Sadio Mane collect di ball wey im shoot for goal; Courtois bin make igbionge save, bifor di ref later call for offside.

83" Chance! Tielemanns strike di ball inches wide off di crossbar.

82" Chance for Belgium! Castagne head one Lukebakio cross wide.

81" Lukebakio don misplace anoda pass for throw ball for Senegal.

80" Moreira bin dance around wit di ball for many seconds , im now try to use di outside of im boot to pass di ball to im teammate for defence, but im rather foul di Senegal attacker, Freekick for di edge of diu Belgium box.

79" Lukabakio dash di ball to Sadio Mane for di Belgium area wey dem begin to attack but Thomas Meunier don block di ball

ThomasMeunier don enta di ga,e to replace Ce Cuyper.

77" Chance! Lukabakio get chance to shoot from di edge of di box, in left footed shot miss di post by inches.

76" Senegal block anoda Belgoum attack and try to start one quick counter attack but di ball be too hard for Sadio MANE

75" Belgium bin dey prepare anoda substitution to try and find di goal.

74" Lukabakio lose possession in front of di Senegal area, im sit for ground as Senegal begin to attack

72" Habib Diarra di first goal scorer comot, Pape Mata Sarr don enta. Also Ilimann ndiaye comot for Mbaye

Senegal gat 20 minutes plus added time to qualify for di R16, Belgium gatz 20 minutes to rescue dia World Cup campaign.

WATER BREAK!

68" Senegal keeper Diaw catch di ball wey bounce for air afta im defender balloon di ball

66" Pape Gueye don comot wey dem replace am wit Lamine Camara. Di midfielder wey no chop up to one minute for di park, chop yellow card for foul on Trossard.

65" OFFSIDE! Trossard bin try to reach one ball wey Lukaku don hold up, di Arsenal man foul im marker but referee already raise hand for offside.

63" Brandon Mechele chop yellow card for foul on di goalscorer Ismaila Sarr.

62" Vanaken don comot, Moreira don enta di game for Belgium

61" Belgium bin dey create more chances now, Lukabakio get anoda chance to shoot afta Lukaku put di ball on top plate for am, but Senegal defend well.

60" Corner to Belgium. Tielemanns bin shoot on target to try and catch di Senegal keeper for di first post. Di subsequent corner be poor. Senegal clear dia lines.

59" Belgium chance. But Senegal defenders put dia bodies for di floor to block di shot from Lukabakio.

57" Diatta bin win freekick afta Raskan don foul am minutes afta im enta di game.

Senegal dey attack for di far left side and almost create anoda goal chance.

56" Raskan and Lukabakio don enta di game. Make we see if dem fit inspire any comeback.

54" Belgium dey for serious trouble now. Doku dey try to dance around im markers but no end product. In fact dem don comot am and De Bruyne for di game now.

GOOOAL! Brilliant goal by Ismaila Sarr. Di striker collect one ball ova di top for im chest, wey im smash di ball into di net. 2-0

50" Chance! Senegal nearly score dia second goal. Habib Diarra bin miss di chance afta Sadio Mane pass di ball to am inside di box.

48" De Cuyper misjudge one pass wey di ball comot for thrwo-in.

46" Belgium begin di second half wit poor passes for midfield, Senegal take advantage to now keep di ball

Chance! Ilimann Ndiaye get big chance to score afta small Senegal pressure, but im left-foot effort go wide, im no test Courtois.

45" Referee don blow whistle for di second half to start. Senegal don pass di ball.

Belgium carry dia all-time top-scorer Lukaku dey enta di game to try and find di goal. Im dey replace De Ketelaere.

Belgium dey struggle to breakdown di Senegal defense, dem fit do am for di second half?

belgium have been struggling to create anything in the Senegal area

Wia dis foto come from, ALEX GRIMM/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Senegal dominate di first 45 minutes wey dem create more chances to score

45+5" HALFTIME!

45+4" De Cuyper shoot di freekick straight for di wall. Di chance don waste.

45+3 " Freekick to Belgium for di front of di Senegal box wit seconds to halftime.

45+1" Senegal get counter attack - di ball fall to Iliman Ndiaye, im hold di ball too long wey di chance vanish.

Dem don announce five additional minutes for di first half.

+5 mins

44" Chance! De Cuyper bin shoot from outside di box afta di short corner, Morv Diaw bin make unbelievable save dia.

Corner to Belgium now!

43" Chance for Belgium. De Bruyne find Doku, but afta di Manchester City attacker dance inside di box, im shot dey deflected into di hands of Morv Diaw di keeper.

42" Belgium recycle possession afta Senegal try to play on elong ball to dia striker.

41" Freekick to Senegal, Diatta say De Cuyper bin foul am. Im dey for ground.

40" Belgium dey pass di ball around di Senegal box dey try to find space, De Cuyper carry di ball go di far left wey im put one low cross inside di box - Senegal clear am.

39" Long cross into di Senegal box, easy catch for Morv Diaw.

37" Doku still dey try to create sometin for Belgium, im dance around bifor passing di ball to di box, De Bruyne no fit reach di ball, Senegal now clear dia lines bifor Trossard go reach dat ball.

35" Senegal dey knock for di Belgium door. Mane enta di box afta some fine play by Gana Gueye but di shot dey weak for Courtois.

34" Throw-in to Belgium for di far right, Doku nd De Bruyne try to play di one-two wit Doku but Senegal block di ball.

32" Mane try to collect one long ball ova di top, but im no fit reach dia. Goalkick for Belgium.

Senegal get 5 shots wit 2 on target and one goal, Belgium get only 2 chances wit one on target.

31" Senegal coach Pape Thiaw dey give im players sign say make dem use dia head and calm down.

Belgium go hope to get quick equalizer but ref don stop di game again. Some intruder don enta di park.

30" Game don restart.

WATER BREAK!

26" Dat Senegal goal na one wey dem deserve sake of na dem create di beta chances for dis first 20 minutes

24" GOOOOAL! Habib Diarra score for Senegal. Mane bin cross di ball, Courtois no fit catch di header, di ball hit di post back into play wey Diarra tap inside di net.

23" Senegal dey maintain di ball well for di last one minute, Belgium dey struggle to block dem.

22" Teranga Lions dey pass di ball around very well, Belgium no fit collect, dem win thorw ball for dia effort.

20" Di pressure don calm down small, Senegal dey try to maintain possession small bifor dem go try to attack.

19" OFFSIDE! Mane dey offside - Senegal begin to counter afta De Bruyne im pass towards di striker no reach am. But bifor Mane go collect di pass, dem don raise flag for offside.

18" Corner to Senegal. Mane play one cross-field to Diatta. Di fullback bin dey ready to cross di ball into di Belgium box, but dem defend dia lines

16" Gana Gueye shoot from outside di box afta Senegal break for di counter attack. Im shot dey simple for Courtois.

15" Theate don clear one dangerous ball for Ismaila Sarr from Sadio Mane.

14" Sadio Mane dey tok im teammates to calm down and use dia head as di game don dey become end-to-end.

12" Chaaance! Ismaila Sarr bin miss ogbonge chance. Courtois almost dash Senegal goal for dia. Di keeper palm di ball straight in front of Ismaila Sarr but di striker im soft touch carry di ball go wide.

11" Di game bin dey settle but Tielemanns don dash ball to Senegal for midfield.

Senegal bin cross di ball from di far right but nobody fit apply di touch to score.

10" Senegal try to counter quick quick but Belgium man foul di attacker, Ref don blow whistle.

8" Chance for Belgium! Trossard shoot on goal but Diaw catch am easy, afta De Ketelaere fail to play di shot when im get di chance.

7" For di last 40 seconds di two teams bin dash possession to each oda under no pressure.

6" Sadio Mane win freekick inside di Senegal half. Dem play am short, wey dem begin to pass am among diaserf for defence.

5" Chance! Belgium drive forward wit Castagne, di defender cross di ball inside di box but bifor im go find im teammates, Senegal don clear am.

4" Senegal dey play some fine combination for di front of di Belgium box, Ilimann Ndiaye and Sarr combine but di final pass don miss.

Throw-in to Belgium but dem carry di ball give Senegal, di Teranga Lions no fit progress

3" Doku try to twist and turn inside di Senegal box for dia first attack bifor di defenders clear di ball.

2" Senegal begin to drive down di flank - Sadio Mane reach di line wey im cross di ball, Belgium clear dia lines

Belgium begin to pass di ball among doaserf bifor dem lose possession to Senegal. Di Teranga Lions also try to string some passes togeda.

1" Afta di fans countdown for di stadium, referee Said Martinez don blow whistle for di game to start.

All players and staff form around di circle wia dem sing di two national anthems.

Wit di cheers from di fans, di players waka comot di tunnel wey dem enta di park.

Belgium bin dey wear dia sea blue and white jersey, Senegal dey wear dia green jersey.

VAR referee na Guillermo Pacheo from Mexico, assistant VAR Rodolpho Toski from Brazil and Carlos Del Cerro Grande from Spain.

Fourth official and reserve assistant referee comot Colombia – Andres Rojas and Alexander Guzman.

Center referee for di game na Said Martinez from Honduras wit assistant 1 and 2 all from Honduras – Walter Lopez and Christian Ramirez.

Di weather dey perfect for dis R32 game as di Red Devils and Teranga Lions wan qualify to di R16.

Holaaaa! Welcome now to di Seattle Stadium for di US as for di first time neva, Senegal and Belgium dey jam each oda.

both teams have momentum after emphatic wins on in theor last games

Wia dis foto come from, MICHAEL MILLER/ALEX GRIMMVIA GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Dis be di first time Senegal and Belgium dey face each oda

First Half

Welcome to dis ogbonge match between 2021 Afcon winners Senegal and di Red Devils of Belgium – di last of di 'golden generation'.

Di Teranga Lions go hope to become di second African kontri to qualify for di R16 afta Morocco.

Two oda African kontris – Ivory Coast and DR Congo now don join Tunisia to comot for di tournament.

But wit di way Senegal take qualify for dis R32 (as one of di best third-place teams), dem go hope say tins go work for dia favour.

For di Red Devils, dia last game against New Zealand wen dem sama dem 5-1 give dem confidence say dem fit win dis game.

But afta 90 minutes and maybe 120 minutes, we go find out which of di two teams go qualify.

E go be di Teranga Lions or di Red Devils?

Only time go tell.

Make we check di lineups for di two teams as Pape Thiaw and Rudi Garcia prepare to jam each oda.

Senegal XI: Morv Diaw (GK); Pathe Ciss, Niakhate, Kreptin Diatta, Ismail Jakobs, Gana Gueye, Pape Gueye, Habib Diarra, Sadio Mane ©, Iliman Ndiaye, Ismaila Sarr

Belgium XI: Courtois (GK); Castagne, Theate, Mechele, De Cuyper, Vanaken, Tielemans ©, De Bruyne, Trossard, Doku, De Ketelaere

Make you join us at 8PM GMT (9PM WAT) for live commentary for dis game for di Seattle Stadium for di US.

Buildup

Di Teranga Lions go jam wit di Red Devils of Belgium for dia R32 clash for di 2026 Fifa World Cup on Wednesday night.

Senegal qualify for dis round afta dem win only one game out of di three group stage games.

Dem lose 3-1 to Group I winners France, Norway sama dem 3-2 bifor dem thrash 10-man Iraq 5-0.

Wit di fresh format for qualification, Senegal be one of di eight best third-place teams wey progress wit three points and positive goal difference sake of di plenti goals dem score against Iraq.

Critics say di Teranga Lions no show for di group stage, na so dem dey expect dem to turn up for di knockout stage.

Senegal progressed by the skin of their teeth

Wia dis foto come from, THOAGO SZWARC/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Senegal coach Pape Thiaw admit say im tem start di tournament slowly but dem go dey ready for Belgium

For Belgium, dem finish dia group G unbeaten – one win and two draws.

Di Red Devils play 1-1 draw wit Egypt, wey dem draw 0-0 wit Iran bifor dem scata New Zealand 5-1 for dia last group game.

Small small, dem also dey show for di tournament but dem gatz overcome di 2021 Afcon champions Senegal if dem go reach di round of 16.

Di two teams go face each oda for di Seattle Stadium later on Wednesday as dem go try to keep dia momentum.

Wetin di coaches tok ahead of di game

Belgium coach Rudi Garcia tok say Senegal na di best of di third-place teams wey qualify for dis round, but im team dey physically ready to face dem.

"Evribodi dey available for dis game, na good tin sake of e neva dey so for us for di first three games," Garcia tok.

Lukaku wey be Belgium all-time scorer score one goal wey im make impact from di bench for dia game against Egypt, im dey fit and available.

Jeremy Doku wey miss dia second game wit Iran sake of im travel to witness di birth of im pikin, now dey available.

Rudi Garcia say im wish dem win more games for di group stage bifor but e neva be too late to continue dia winning streak.

For Senegal coach Pape Thiaw, im admit say di Teranga Lions neva start di tournament well but im believe say di team go dey ready to jam wit Belgium.

"We gatz win dis game, we dey determined. Na different competition now from di group stage, di fact say you win di group no mean say oda teams no go fit scata you, like wetin Morocco bin do to Netherlands."

Thiaw add say "we don work on our team, di mistakes we do against France and Norway, di individual errors, we don fix dem, we go dey ready for di Red Lions".

Belgium attacker Leandro Trossard wey don shine for dia group games say im dey feel good ahead of di game.

"Pipo don happy, di atmosphere dey high for my kontri, I tink say we dey grow in dis tournament," di Arsenal forward tok.

For Senegal midfielder Papa Gueye, time don reach for dem to show dia quality.

"We bin need to show anoda side of our team for dat Iraq game; wey we show di whole world di team we be."

Ismaila Sarr dey lead wit three goals wey Papa Gueye wey comot di bench to score two goals against Iraq, dey in line to start di game.

Lukak came off the bench to assist AND SCORE

Wia dis foto come from, JAMIE SQUIRES/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Lukaku na Belgium all-time top-scorer

Possible lineups for both teams

Belgium XI:

Courtois (GK); Castagne, Mechele, Theate, De Cuyper; Tielemans ©, Vanaken; Doku, De Bruyne, Trossard; Ketelaere

Senegal XI:

Diaw; Diatta, Seck, Niakhate, Jakobs; Diarra, Gueye ©, Camara; Mbaye, Sarr, Mane

Di game go happun at 8 PM GMT (9PM WAT) for di Seattle Stadium.

Make you join us for dat time for di live commentary.