'My papa no wan die' - Ogogo daughter cry out ova actor stage 4 cancer

Taiwo Hassan

Wia dis foto come from, @ogogotaiwohassan/Instagram

Published
Read am in 3 mins

"I no want my papa to die," dis na some of di words from Nigerian Yoruba actor Taiwo Hassan daughter wey come online to cry for help to save her papa wey dey suffer from stage four cancer.

Di Nollywood actor wey dey popular as Ogogo dey trend afta im family reveal say e get stage 4 cancer.

Im daughter cry for di video wey don dey go viral on social media as she say hospitals wey dem carry her papa go, no gree treat am again.

She dey ask di public if dem kknow anybody or facility wey fit treat her papa to reach out to dem.

"I dey hia to ask for help for my daddy, im get cancer and e dey really really bad. Many hospitals no gree treat am, at least , abeg make una give dis man chance.

Nobody wan do anytin, we no dey ask for money, if you know pesin wey know pesin wey fit treat am, make una help!"

Im daughter add say she no fit imagine say her papa go die and wetun dey pain her pass be say her papa get strong will to live.

"Dis man get strong will to live. If you see am you no go even know say sometin dey wrong wit am wey bad well -well, e just start to dey show."

According to her di cancer just begin show and na three weeks ago dem diagnose am of di life-threatening disease.

"We bin no even know untill like three weeks ago, so abeg , I dey beg una, if you know pesin wey know anoda pesin wey go fit treat am, we dey ready to try anytin, abeg we no dey hia to ask for money"

She add say her papa dey suffer from stage four cancer and her big uncle na im dey help wit di hospital bills since dey notice say im get cancer.

"I no want make my papa die, hospital dey tok say dem no go fit treat am again.

I no dey here to beg for money"

She also appreciate pipo wey don help her so far we dey foot di bill since especially her uncle.

Taiwo Hassan na Nollywood actor , wey dey popular for im multiple roles for di Yoruba feem.

Im don dey around for a veri long time and na face wey pipo wey dey watch feem well-well fit recognise.

Taiwo Hassan dey 66 years and na veteran actor for Nollywood.

Tori be say im acting career career don pass fourty years and im don act ova 300 feems for yoruba.

Di family no tok di type of cancer wey im get and ad im daughters say na who fit treat dia papa dem dey find.

We dey update dis tori