Former Cambridge University academic Jason Arday don die afta accuse of magomago

Wia dis foto come from, ITV / Shutterstock
Di former University of Cambridge professor wey dey di centre of plagiarism don die.
Dem find Jason Arday "unresponsive" for one address for Battersea, south London, on Friday afternoon, emergency services tok.
Di London Ambulance Services bin call Metropolitan Police officers. One 41-year-old man bin dey pronounced dead for di scene and im next of kin don dey informed, di force tok.
Arday bin resign as Cambridge professor of sociology of education last week afta allegations of plagiarism and questions about some of im achievements. Im bin deny di claims.
For one statement, di Met Police say: "At dis time, we dey treat im death as unexpected, but e no dey believed to dey suspicious."
Di 41-year-old academic bin denied any plagiarism - but admit errors for im work - and last week e say di recent kasala bin lead to how pipo dey chook eye for im mata and dey attack am personally.
Di mata first happun afta anoda academic - self-defined "race realist" Nathan Cofnas, wey dem sack from im Cambridge role for 2024 - say e find plenty instances of plagiarism inside Prof Arday work and question some of im stated achievements.
Dem bin hail Arday appointment as Cambridge youngest ever black professor for 2023 as progressive moment.
Some critics say na racism motivate di way dem treat am, but odas tok say di claims of plagiarism dey legit.
Arday, wey announce im resignation last week, say di "personal cost" of di scrutiny no be small tin.
E say: "While criticism na inevitable part of academic life, wetin I don experience don go far beyond scholarly disagreement.
"Di relentless accusations, speculation and public commentary don take profound toll on me and on dose wey I love."
E say make pipo no mistake im resignation "as acceptance of di narratives wey don surround me".
BBC News Pidgin bin report say one group of academics bin call for independent investigation into di appointment of Arday.
Di professor of education also dey face accuse say e forge or exaggerate some tins for im CV.
E don defend imsef and im work.
Pipo now don turn dia attention to how Cambridge university take dey handle di concerns about Arday, wey bicom dia youngest-ever black professor for 2023, plus im upcoming memoir.
Priyamvada Gopal, professor of postcolonial studies for Cambridge, wey also dey among dose wey dey call for independent investigation, say di university dey face "big reputational damage" ova di affair.
We dey update dis tori







