Why Niger military change dia heads of service?

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images
Niger military rulers don replace di head of di armed forces.
Dis dey come less dan two weeks afta one deadly mutiny wey bin challenge dia authority.
One decree wey dem read on state television late on Friday, 11 September, bin announce say Brigadier General Mamane Sani Kiaou na di new chief of staff.
Im succeed Major General Moussa Salaou Barmou, wey he senior junta figure since di July 2023 coup wey bin remove President Mohamed Bazoum.
Di reshuffle dey come afta one dramatic 24‑hour mutiny for Niamey at di end of August.
Young sojas bin storm di Base 101 for di airpoTy wey dey di capital as dem bin take colleagues hostage.
Dem bin also fire sensitive sites. Analysts say dem bin dey para sake of militant violence and poor conditions wey dey worse.
Presidential guard units bin struggle to take back di base until Russia Africa Corps intervene wit ground and air support.
Tori be say dozens of mutineers either kpai or dem detain dem.
Though authorities neva confam di actual number. Three guard members also kpai.
Di airport now dey host Russian forces and di joint Sahel alliance wit Mali and Burkina Faso.
Security dey worse since Niger bin end military cooperation wit France and di United States, according to analysts.
Dis reshuffle dey show how weak di junta grip on power, as Niger dey face mounting insurgent attacks and growing reliance on foreign military backing.
Wetin don happun for Niger recently
For August, Niger fight to regain control of dia key military airbase for di capital, Niamey, afta revolutionary soldiers attack di site plus oda strategic locations.
Di fighting, wey start early on Saturday, 29 August na di latest challenge to military ruler Abdourahamane Tiani, wey im govment for a long time now dey battle long- and increasingly severe jihadist insurgency.
Niger authorities tok say dem contain di opposition sojas and forces wey dey loyal don restore order.
Di Ministry of Defence explain say some group of soldiers wey break military rules bin detain some of dia colleagues for Base 101 for di early hours of Saturday, 29 August.
Di sojas also open fire for several sensitive locations for di capital, di ministry tok.
Niger state-run television bin describe di attacks for Niamey, as attempted coup, but say di situation dey under control.
Earlier reports say di mutineers bin try to detain military personnel for di base and dem fire gunshots on several sensitive locations for Niamey.
Heavy gunshots and explosions blast across parts of Niger capital, Niamey early mormor on Saturday, according to eyewitnesses. Dem say serious fight happun near Diori Hamani International Airport, di military Base 101 and di presidential palace.
By September 2026, Niger army say dem find large amount of weapons and military equipment for Base 101 for Niamey afta di failed mutiny wey happun for different parts of di kontri.
Dem say di weapons wey dem uncova include heavy weapons, rockets, explosives and large quantities of ammunition.
According to di state broadcaster Tele Sahel, dem say di ammunitions wey di Niger Army find and di kain amount wey dem find na serious threat to di kontri capital and oda military formations.
Base 101 na strategic military air base formation for Niger capital, and e no far from di airport too.






