Outrage as police officer 'execute' man for public inside viral video

- Author, Gift Andrew
- Role, Reporter
- Read am in 4 mins
Nigeria police don arrest dia officer wey arrest and shoot to death one suspect for Delta state, south south of di kontri.
For statement, police confirm say dia officer wey im name na Nuhu Usman discharge im fire arm and shoot di victim against dia standard procedure and e lead to im death.
Video wey BBC News Pidgin sight show di suspect wey im name na Mene Ogidi sidon for ground near one police van, dem tie him hands and legs.
Police say di incident hapun on Sunday 26th April 2026.

Wia dis foto come from, NIGERIA POLICE
For di video, di victim wey sidon for ground dey beg di officer say im no know anytime but im go carry dem go to di pesin wey send am to collect one item.
Tori be say im bin go waybill package for one logistics company wey turn out to be guns.
Some locals say di victim receive waybill for motor pack, but di drivers discovers say di parcel get gun inside.
As im come to pick up di parcel, dem catch am and den alert police.
End of Di one wey oda users dey read well well
But as police arrive, instead of to carry di suspect and investigate di mata, dem shoot am dia.
Di video show say di officers no listen to am, two police officers dey try cock dia gun for about a minute, dem remove di magazine of di gun and put am back.
Before dem shoot di suspect, im dey shout "officer abeg I go tell you evritin, na my friend deceive me. E dey Sapele."
"Abeg abeg, I no know anything concerning am, I go carry you go meet am, e dey Sapele like dis, officer I go carry you go meet am abeg, officer, I go carry you go meet am officer, officer... I no know officer abeg, I go carry you go meet am".
As e dey beg di officer dey busy dey cock dia gun. As dem cock di gun, di officer wey dey on mufti release di bullet into di victim and e slump immediately.
After dem shoot am once dem carry am put inside dia inside dia sienna car carry am move go dia station.
Tori be say dem shoot am more times for dia station before e die.

Wia dis foto come from, Di victim
Wetin police don do so far on di case
Meanwhile, Nigeria police say dem don dey look into di mata and promise to bring justice to di victim.
Dia tok tok pesin Okon Placid for statement condemn di action of di officers, say dem violate di regulations of di police.
Di statement say di officers from di Effurun Area Command respond to credible information from Benin Motor Park wey dey along Warri Sapele expressway about suspect wey transport union catch as e wan do waybill way contain Beretta pistol wit four rounds of ammunition.
E say na as dem dem try take di suspect into custody na im dia team leader discharge im firearm wey lead to di death of di suspect.
Delta State police command release anoda statement wia dem say dem don arrest all officers wey follow go di operation on di directive of di Delta state Commissioner of Police Yemi Oyeniyi.
Dem don move dem to Force Headquarters Abuja on di order of di Inspector General of police.
E say di police IG don console di family of di deceased and promise to ensure say justice dey served.
Di video dey trend for social media as pipo dey condemn di action of di police.
Pipo enta social media to demand make police IG mandate all dia officers wey dey on duty to dress properly and wear name tags for easy identification.
Nigeria police dey notorious for extrajudicial killings, brutality and assault, dis lead to di popular EndSARS protest wey hapun for 2020 and later authorities disband di den police department known as SARS.
But years after, stories of incidents of police brutality and extrajudicial killings still dey make di rounds for di kontri.











