In fotos: Di looks wey steal di night for di AMVCA 2026
Read am in 5 mins
Di 2026 edition of di Africa Magic Viewers' Choice Awards on Saturday 9 May na anoda grand celebration of African film, fashion and storytelling, wey bring togeda di continent biggest stars for a night filled wit glamour, emotion and well-deserved recognition.
From ogbonge red carpet appearances to defining career moments on stage, di ceremony once again prove why di AMVCA remain one of di most prestigious platforms for African entertainment.
Linda Ejiofor double victory na one of di defining highlights of di night, and e further cement her place as one of Nollywood most versatile performers.
Uzor Arukwe win di Best Lead Actor for Colours of Fire, while Bucci Franklin win di Best Supporting Actor for To Kill a Monkey.
For Uzor Arukwe, di lead actor win mark anoda major milestone for im career wey don continue to gain momentum in recent years.
Wetin we call dis foto, Osas Ighodaro come prepared for di AMVCA 2026.
Wetin we call dis foto, Queen Mercy Atang dress still dey make pipo tok.
Wetin we call dis foto, Nana Akua Addo come 'cathedralled'.
Wetin we call dis foto, Buchi Franklin win di Best Supporting Actor for di AMVCA 2026.
Wetin we call dis foto, John Tyler Ekanem keep am classy and effortlessly stylish for di AMVCA 2026.
Wia dis foto come from, AMVCA red carpet
Wetin we call dis foto, Simi Drey rock dress wey dem make from glass.
Wia dis foto come from, AMVCA red carpet
Wetin we call dis foto, Uche Jumbo grace di red carpet wit beaded dress wey dem style elegantly to fit her fashion taste and style.
Wetin we call dis foto, Style meet confidence as Sunshine Rosman grace di AMVCA 2026 in flawless dress.
Wetin we call dis foto, Lateef Adedemije film Lisabi win di Best Indigenous Language Film (West Africa). Di same film also give am nomination for Best Lead Actor wey Uzor Arukwe win.Dem also nominate Lateef Adedimeji for Best Supporting Actor wey Bucci Franklin win.
Wetin we call dis foto, Racheal Okonkwo wear beaded pink and blue dress to show dem say she come preapred for di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Uche Jumbo show up ready for di spotlight for di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Bisola Aiyeola bin dey nominated for Best Supporting Actress for Gingerrr, but na Linda Ejiofor win am for The Herd
Wetin we call dis foto, Kanayo O Kanayo win Industry Merit Award.
Wetin we call dis foto, Uche Montana win di Trailblazer Award for di AMVCA 2026.
Wetin we call dis foto, Anita Natacha Akide grace di AMVCA 2026 wit sequin dress wey make am look refined, stylish, and red-carpet ready.
Wetin we call dis foto, Oluwabukunmi Adeaga-Ilori, wey pipo sabi as Kiekie, no carry last for her fashion style to di AMVCA 2026
Wetin we call dis foto, Bolaji Ogunmola dress to di AMVCA 2026 give am aura of confidence.
Wetin we call dis foto, Tobi Bakre serve timeless style wit im agbada for di AMVCA 2026.
Wetin we call dis foto, Yolanda Okereke step into di AMVCA 2026 looking evri bit of sophisticated.
Wetin we call dis foto, Lesliana Pereira definitely understand di assignment for di AMVCA 2026 wit her butterfly dress.
Wetin we call dis foto, Stan Nze bring class and elegance to di AMVCA 2026 red carpet wit dis polished look.