South Africa deport nearly 39,000 undocumented foreign nationals

Wia dis foto come from, Sharon Seretlo/Gallo Images via Getty Images
Govment for South Africa say dem don deport about 39,000 undocumented foreign nationals in seven months.
Dis na as law enforcement dey carry out immigration enforcement according to di law.
"Between 1 April and 31 October 2026, dem don run 38,982 deportations. E include di 31,878 from di Lindela Repatriation Centre and 7,104 from di provinces."
South African authorities tok dis one during di Inter-Ministerial Committee (IMC) on Migration media briefing wey happun for Thursday.
Di committee chairperson and Justice and Constitutional Development Minister, Mmamoloko Kubayi, torchlight say all di enforcement and deportation processes still dey go wit wetin dey 'immigration legislation and legal safeguards.'
Di Minister tok say "govment go continue to strengthen collabo wit di kontris of origin to facilitate di identification, documentation and return of dia pipo."
She say di effectiveness of immigration enforcement 'no be by arrest dem dey use judge am but also di lawful conclusion of immigration.'
'About 4,000 suspects arrested for immigration Act'
Di Justice Department say e dey work wit Home Affairs to ensure say di deportation and repatriation process go well.
"Di Department of Home Affairs, working wit law enforcement agencies and relevant foreign missions, kontinue to coordinate deportation and repatriation processes."
South Africa say dem go cooperate wit countries of origin to identify, document and return dia nationals back to dem.
Di authorities say through Operation Shanela, police and partner agencies dey kontinue to pursue immigration-related offences togeda wit oda criminal activities.
Dem say di operations dem dey help identify and arrest pipo wey dem suspect say dem break immigration laws.
"Between 26 October and 8 November 2026, dem arrest 2,593 suspects across different provinces for breaking the Immigration Act."
"Between 9 and 15 November 2026, dem arrest another 1,777 suspects across different provinces for breaking the Immigration Act."
'70 undocumented foreign nationals detained for fresh arrest'
Anoda operation wey police conduct for Tshwane District on Thursday, 19 November 2026, result in di arrest of 407 suspects for various criminal offences.
Di operation bring togeda members of di South African Police Service (SAPS), di Department of Home Affairs, and oda agencies wey help for di arrest of suspects.
"Dis efforts result in di arrest of 309 wanted suspects linked to various serious and violent crimes. Among dose arrested na two suspects wanted for child abuse, one for bribery, two for attempted murder, two for house robbery, and seven for rape."
Meanwhile, some of di arrest also torch on immigration matters.
During di operation, "total of 70 undocumented foreign nationals' enta detention, while six individuals dey arrested and fined for employing undocumented foreign nationals."
'No individual get authority for immigration enforcement'
E don get reports of situations wia unathoritised pipo dey beat and chase foreigners comot for South Africa.
Justice minister say dem get public order operations wey go "prevent violence, intimidation, illegal protests and attacks against pipo and businesses."
She explain say through di National Joint Operational and Intelligence Structure (NATJOINTS), police and oda law enforcement agencies still dey monitor emerging threats and coordinate dia responses.
She say although govment understand pipo concern about irregular migration, unemployment, crime and pressure on public services, dem no go tolerate lawlessness.
Di Minister tok say dis concerns no "justify vigilante actions, illegal identity checks, intimidation or attacks against foreign nationals."
"No individual, organisation or community group get the authority to take over the immigration enforcement responsibilities of the government.
"Di IMC don repeat say peaceful protest na constitutional right, but violence, criminal intimidation and incitement go face serious action."
DI minister add say dem go monitor to make sure say nobody go against dat law.

















