Manchester United part ways wit head coach Michael Carrick

Wia dis foto come from, MICHAEL REGAN/GETTY IMAGES
English club Manchester United don part ways wit head coach Michael Carrick.
Dis na afta series of poor performances wey cause United to dey battle relegation for dis time of di season.
Di club bin dey 18th afta 10 games only above Sunderland and Crystal Palace.
Dem also win only one match for di last nine games dem play for all competitions, wey make di club to consider di future of dia coach.
Afta di meeting of di leadership for Monaco, tori dey comot say dem don let Carrick go.
"Manchester United fit confam say Michael Carrick don depart im role as men first-team head coach," statement tok
"Afta disappointing start to di season, di club don come to di extremely difficult conclusion say change dey necessary in order to achieve our ambitions"
How Carrick takeova Man United
Wen Michael rejoin di club for January, e guid di team to third-placed Premier League finish by winning 12 out of di remaining 17 games of di 2025/26 season, accumulating di highest points tally in di league during dat period.
Di former midfielder for di club don manage di team two separate times as caretaker coach when di club sack dia managers.
Im first manage di club for November – December 2021afta dem fire Ole Gunnar Solskjaer; Carrick supervise three games – im win two of those games wit one draw.
For di second spell as interim coach afta dem sack Ruben Amorim from January – May 2026, im lead di club to finish third and qualify for di Champions league dis season.
Since dem confam am as manager for 22 May 2026, tins no get click for di 45-year-old, wey now put am under pressure.
Di club dey hope say di new managerial direction go change di fortunes of di club from di relegation battle dem dey face.
Manchester United come from 2-0 down to draw 4-4 wit Aston Villa for di premier league.
Bifor dat, dem bin stage ogbonge comeback from 2-0 down to win 3-2 against AS Roma for di Champions League.
Dem earlier lose 2-0 to Chelsea, 3-0 to Bournemouth and 4-1 to Como for di Champions League.
Dem draw 1-1 wit leads and lose 2-0 to Atletico Madrid wey dem draw 1-1 wit Fulham.
Dis poor results don force di hand of di owners of di club wey decide say time don reach for change.
Who go replace Carrick

Wia dis foto come from, VISIONHAUS/TAYLOR BANNER/GETTY IMAGES
Mauricio Pochettino wey be USA men's team coach dey ready to accept di offer to manage di English club, according to reports.
Sources don tok BBC Sport say di former Chelsea and Tottenham boss dey ready to take charge of di red devils, but United gatz settle im $10m release for im current contract wit di USA team.
Sources say Manchester United go soon announce dia new direction, wey e dey very likely say Michael Carrick go lose im job.
Profile of Mauricio Pochettino wey dey likely to become new United manager

Wia dis foto come from, ROBIN ALAM/ISI/GETTY IMAGES
If dem confam Pochettino as new manager, im go be di eight permanent head coach for di Red Devils since Alex Ferguson retire for 8 May 2013.
Di USA national team bin appoint di former Chelsea manager for September 2024 to prepare di team for di 2026 World Cup.
Im agree for contract wey suppose last till 2030; di USA national team reach di R16 for di new World Cup format bifor dem lose to Belgium.
Bifor dat, Poch spend only one season as coach Chelsea between 2023 and 2024.
Di Argentine struggle to get results for di first part of dat season wey im dey under pressure bifor im win last five games of di season to finish sixth.
Poch coach Paris Saint Germain for one year – 2021 to 2022 bifor dem sack am sake of di club comot di R16 for di Champions League dat year afta dem finish for semifinals di year bifor even though im win di league and coupe de France.
Im recent long spell na when im coach Tottenham for five years from 2014 to 2019.
Dem sack am afta di club start di 2019 season 14th for di table. Im memorable result na when im carry di club reach di Champions League final when dem lose 2-0 to Liverpool.
Pochettino don coach Espanyol (wia im begin im coaching career) and Southampton bifor.
For im coaching career, im don win three trophies – all of dem when im bin coach PSG for France.
Di Argentine be di pesin to rescue di season for Manchester United?


















