How two buildings collapse for Lagos and Rivers states within 24 hours trap and kpai pipo

Authorities don confam say eight pipo don die and several odas injure afta three-storey building collapse on Thursday for Alakija, along di old Ojo Road toward Satellite Town for Lagos State, southwest Nigeria.
Di Lagos State Emergency Management Agency confam di latest casualty figures for one statement wey dia Permanent Secretary, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, issue.
"Search and rescue operations remain ongoing. Further updates go dey provided as more information become available," e tok.
Di Lagos State Fire and Rescue Service say di building na residential structure wey bin dey occupied by multiple residents at di time of di incident.
Dem bin rescue 10 pipo wit varying degrees of injuries and don hand dem ova to medical personnel for necessary treatment.
Di fire service say search and rescue operations dey go on as emergency responders continue efforts to locate and evacuate pipo wey fit still dey trapped under di rubble.
Dis dey come less dan 24 hours afta anoda building collapse claim one life for Port Harcourt, Rivers State.
Port Harcourt building collapse
Di four-storey building, wey dey located along Peter Odili Road, collapse while construction work bin dey go on.
Several workers bin dey trapped for di debris, and e prompt large-scale rescue operation involving emergency agencies and security personnel. Dem bin rescue three pipo wey currently dey receive treatment for hospital.
Di twin incidents don draw attention to di persistent problem of building collapses across di kontri.
Experts don repeatedly blame such disasters on structural defects, di use of substandard materials, poor supervision and failure to comply wit approved building standards.
For Lagos, emergency officials say rescue efforts bin dey intensified immediately afta di collapse, wey lead to di recovery of 10 survivors.
"As of di time of dis report, 10 pesins don dey rescued alive wit varying degrees of injuries and dem don dey di hands of medical personnel for necessary treatment," Lagos fire service tok.
Meanwhile, di Rivers State authorities don commence inquiries into di Port Harcourt collapse to determine weda di building comply wit safety and construction regulations.
Architect Tosan Omatsone, di chairpesin of di Nigerian Institute of Architects, Rivers State chapter say dem dey concerned say dis na di second building to collapse within 48 hours for Port Harcourt.
Dis na becos anoda three storey-building bin collapse for di Iwofe axis of Port Harcourt - although nobodi die for dat incident.
She note say looking at di building, only di elevator shaft na im remain and di materials wey dem use dey sub-standard so e no be surprise say di building collapse.
She say as professional bodi, dem wan join bodi wit di state and federal govment to monitor building structures for di state to make sure say pipo wey dey build follow set standards to avoid such disaster for future.









