Ghana sama Somalia 2-0 to keep dia 2027 Afcon qualifying hope alive

Wia dis foto come from, GFA
Di Black Stars of Ghana don return to winning ways afta dem sama Somalia 2-0 for dia 2027 Afcon qualifiers.
Ghana dominate di game from di beginning wey dem finally get dia goals.
Captain Jordan Ayew first miss penalty for di first half bifor di team score bifor halftime.
Defender Jonas Adjetey rise to head di first goal bifor Felix Afena-Gyan score di second goal for 62 minutes.
Since dat time, na only one team bin play di game until di end.
Ghana go dey disappointed say dem no take advantage to score more goals for dis game.
Mohammed Kudus, Daniel Kofi Kyere and Fatawu Issahaku all get chances to score.
Di Ocean Stars of Somalia no create many chances wey dem no test di Ghana keeper for di whole second half.
Di interim manager for di Black Stars Kim Lars Björkegren go happy about dis performance and di fans go dey happy say finally dia team dey win games again.
Di Black Stars dey 75% possession wey Somalia get only 24%.
Dem also get 23 total shots and 8 shots on goal, Somalia get only 3 shots, 2 of dem on target.
Wit dis result, Ghana don climb to third on top di table wey Somalia remain last.
Di Black Stars go soon travel to Somalia to play di second leg for dis qualifier on Monday 16 December.
Second Half
FULLTIME
Referee blow whistle to end di game.
Somalia bin get two corner kicks, Benjamin Asare save one shot wey don dey deflect.
90+4" Di black Stars wan get anoda goal.
90+1" As di game dey come end, Ghana stil dey play to score.
Officials don add five minutes.
+5 mins
Rahim Ibrahim try to shoot for di edge of di box ; di ball enta Row Z!
86" Corner kick to Ghana., Kudus dey take am.
85" Thomas Partey head one corner kick but im header go wide
84" Chance! Issahaku shoot di ball wey hit somebody bifor e go ova.
Somalia dey make double change as di game don dey approach fulltime.
82" FREEKICK for di edge of di Somalia box. Dem fit score?
Di Ghana players don dey have fun now as dey dey pass di balls around
80" Brandon Thomas-Asante dey prepare to enta di game. Partey and Kofi Kyere dey manage tins for di midfield.
79" Fans for di stadium dey chant for di Black Stars, dem dey ask for more goals, but di team dey control tins.
78" So far di Ocean Stars no fit create any beta chance for di second half.
CHAAANCE! Kofi Kyere bin shoot from di edge of di box after but di keeper catch am.
76" For di last minute, ghana bin dey pass di ball around wey dem dey try to score anoda goal.
Ghana bin dey comot dia captain Jordan Ayew now. Kofi Kyere finally enta di pitch again to play afta im suffer injury wey keep am away for three years.
73" Prince Kwabena Adu take im time to put di low cross for di danger area - Fatawu Issahaku no fit stretch to tap dat ball inside di net.
72" Referee don blow whistle for di game to start again.
70" COOLING BREAK
69" Prince KWABENA Adu tin say im win freekick for di edge of dia box but referee say no
68" CHANCE! Fatawu Issahaku don beat im man but im shot dey wide.
67" Jonas Adjetey head di cross from Kudus but di header go wide.
Corner to Ghana. Kudus go play am.
66" Somalia suppose comot to attack and try and get a goal but dem no fit, Ghana dey press dem.
65" Afta dat second goal, Ghana bin increase di tempo wey dem dey attack di Somalia players
63" Dat goal na di final contribution for di game for Afena-Gyan.
61" GOOOOALLL! Felix Afena-Gyan score. Di ball pass thru di hands of di keeper afta Kudus bin pass di ball to di striker.
58" No clear chances for dis second so far.
57" Somalia captain hustle for organisers er.
56" Ghana threaten again
55" Corner to Ghana.
51" CHAAANCE! Anoda dangerous set-piece for Ghana, Fatawu im header no trouble di Saudi
CHAANCE! Mohammed bin dey carry
49" Afena-Gyan bin dey win 50-50 balls and drive for di area, but di end product dey poor.
47" Abdoulahi don block one pass, we fit give wahala.
46" CHAAAANCE! Ghana bin continue to create sometin but so far Somalia don defend dia lines well well
45" Referee bin whistle for di game to start. Somalia don pass di ball for center circle.
Somalia coach Yusuf Nur go hope say im boys go deliver.
Welcome again everybody, players bin dey comot one afta di oda to enta pitch.

Wia dis foto come from, Issouf SANOGO, David Ramos/Getty Images
First Half
HALFTIME
48" Referee don blow whistle afta di black Stars use di added on time to celebrate dia goal.
GOOOOALLL! Jonas Adjetey bin rise to connect wit Salisu im knockdown from Kudus corner kick.
+3 mins
44" Ghana win throw -in; Gideon throw di ball but nothing doing
43" Di first half don dey end still no goals for dis game.
42" Ghana try to play one-two passes in front of di Somalia box but di Ocean Stars no dey gree for di Black Stars at all.
FREEKICK to Somalia after Felix Afena-Gyan don foul one player.
41" Di freekick go ova di bar.
40" Between Jordan and Kudus, who go take dis freekick?
Anoda freekick to di black stars for di edge of di box, defender don foul Fatawu
38" Freekick to Ghana, Fatawu don fall for ground afta foul.
35" Thomas Partey bin play one thru pass for Yirenky, di Coventry City player no fit reach di ball inside di Somalia box.
34" Pressure for di Somalia defence - Ghana bin dey pepper dem wit crosses; Caleb Yirenkyi fail to head one of those crosses for di net
32" Alidu Seidu don foul Hassan for di right side of di Somalia area, refree don blow for freekick.
31" Still goaless afta 30 minutes wit few chances to Ghana.
30" Somalia captain Nour bin dey try to create sometin for Somalia - e no dey successful.
29" Gideon Mensah comot im eye for di ball when Kudus lay di pass for am to try and cross into box, Somalia clear di ball.
Wit di way di game dey go, Somalia go dey happy say dem keep Ghana quiet so far.
26" Di game don restart, Ghana continue from wia dem bin stop.
HYDRATION BREAK NOW!
23" CHANCE! Jordan don head di ball from one Gideon Mensah cross but e comot and di chance don go.
22" Gideon Mensah don clear di freekick wey Ghana begin counter attack - Fatwu and Afena-Gyan bin dey drive for di Somalia area bifor dem clear di ball for di feet of Afena Gyan for throw-in.
21" Freekick for Somalia for di far right afta Ghana defender bin foul im marker.
20" Somalia players bin dey defend for dia own area di whole time, waiting for di counter attack - so far e no dey work for dem.
19" CHANCE! Kudus im weak shot no trouble di keeper at all. Ghana dey drive into di Somalia box.
17" Ghana now dey pile pressure from one side to di oda to pepper di Ocean Stars of Somalia.
16" CHAAANCE! Jordan Ayew carry di ball enta di box wey im shoot low across di goal, di ball don miss di post by inches.
15" Somalia don ginger afta dat penalty save from dia keeper.
Di Black Stars captain be usually solid for di spot but for dat one, na poor kick for di keeper to catch.
14" MISS! Jordan Ayew don miss di penalty. Di goalkeeper Ibrahim Ahmed bon save di penalty.
Alidu Seidu bin win penalty afta Somalia defender pull im short. Ref don give di defender yellow card.
12" PENALTY TO GHANA.
10" Ghana bin dey put pressure for di Somalia box but di final pass no dey go thru.
9" Combination of number 15 and number 3 for Somalia don stop Afena-Gyan for dat attack.
8" Afena-Gyan tink say he bin win penalty but referee say play on.
6" Jonas Adjetey beat im marker for defence wey im play long ball ova di top - Somalia keeper Ibrahim Ahmed don catch am.
5" Freekick to Ghana as di Somalia player foul Kudus but di freekick dey wasted.
4" Ghana dey try create some attack wit Partey and Jordan but anytime dem try, Somalia players dey block all di spaces.
Benjamin Asare don collect di ball two times already for dis opening three minutes.
3" Caleb Yirenkyi miss one fine ball ova di top, Somalia don clear dia lines.
2" OFFSIDE! Ghana player bin dey offside, di game restart fast fast.
Somalia no gree for Ghana to carry di ball enta dia yard, di ball continue dey float for di center of di park.
Thomas Partey, Gideon Mensah and Caleb Yirenkyi bin pass di ball among diaserf
1" Somalia get early throw-in but dia ball comot for throw-in to Ghana.
Referee don blow whistle for di game to begin for di Essipon stadium for di kontris Western Region
Di Ocean Stars of Somalia go hope to also out an end to dia losing start for dis qualifiers.
Di stadium dey packed, di home team dey hope to use di support to turn tins around afta dem lose dia first two qualifiers for Group C.
Mohammed Kudus, Thomas Partey, Jordan Ayew and Mohammed Salisu all return to di team afta dem miss di last qualifiers wit injury.
Ghana dey wear dia all-yellow jersey wey Somalia dey wear dia white and blue jersey.
Officials don lead di players onto di pitch; fans for di stadium dey chant wit di hope to inspire di team.
Welcome everibody to di Essipon stadium for di Western Region of Ghana under di scorching sun.


















