Burna Boy, Shakira, BTS and odas stars to perform for di World Cup Final half-time show

Wia dis foto come from, Getty Images
Burna Boy go follow Shakira, K-pop band BTS and Madonna to headline di World Cup Finals dis Sunday.
Di finale wey dey happun between Argentina and Spain go hold for New Jersey, dis go put end to di newly expanded World Cup Format wey United States, Canada and Mexico host.
Di BBC bin hear say di show go last for 11 minutes, even as tori dey say di show fit pass15 minutes wey be di limit wey di game laws dey put on top breaks.
Dis tori dey come bicos for di last Summer Club World Cup final for di US wey happun between Chelsea and Paris St-Germain, dia half-time show bin last ova 24 minutes.
Currently na normal tin for games like di Champions League final to get performances bifor di match. Howeva, dis ho be di first time wey dem go di half time show for World Cup final.
According to tori from dia social media, Columbian pop star Shakira go sing her official World Cup song Dai Dai, wey she sing wit Nigerian star Burna Boy. Dai Dai na Italian phrase wey mean "let's go" or "come on".
As for di oda pipo wey go perform for di half time show, di 'Queen of Pop' Madonna wey be di best selling female music artiste of all times don drop her 15th album wey she call Confessions II for 3 July.
Meanwhile BTS wey be di best music act for South Korean history go dey di middle of dia 85 date world tour wen dem come to perform for di World Cup.
End of Di one wey oda users dey read well well
A member of di band, JungKook bicom di first to perform for di World Cup during dia military service hiatus for di Qatar World Cup opening ceremony.
Justin Bieber na anoda pesin wey dey expected to play for di World Cup half time show, afta e bin headline for Coachella dis year.
Dis dey come afta e comot from almost four years hiatus to drop two back-to-back albums wey im call SWAG and SWAG II for 2025.
For March, Fifa president Gianna Infantino tok say, di show "go be historic moment for di Fifa World Cup wey be di biggest sporting event for di world".
Di pesin wey dey arrange dis show na Chris Martin from di music band Coldplay and e dey happun to get money for di Fifa Global Citizen Education Fund, one initiative wey dey work to raise like $100m (£73m) for children all ova di world.













