Champions League quarterfinal: Barcelona, Liverpool lose, PSG, Atletico get first leg advantage for UCL

A red card to Barcelona allowed Atletico to secure a positive 0-2 score ahead of the second leg at the Metropolitano next week

Wia dis foto come from, ALEX CAPARROS/UEFA via Getty Images

Wetin we call dis foto, Barcelona lose 0-2 for Camp Nou to hand ova di advantage to Atletico, Liverpool also go hope to turn around 0-2 defeat against PSG
Read am in 6 mins

Di first round of di Champions league quarterfinal games don finish; wit Atletico Madrid, PSG, Bayern Munich and Arsenal all wit good results ahead of di second leg of games next week.

Tins already don set for those games - as di clubs wey lose di first leg games go dey hope to turn tins around.

But e neva go dey easy.

Na so di Champions league dey. If you wan win am, you for be team wey dey play ball well well, wey you gatz show di champion mentality.

Barcelona bin lose 0-2 to Atletico Madrid for Camp Nou on Wednesday wit 10-men.

Young defender Pau Cubarsi chop red card bifor halftime when im foul Giuliano Simeone as di last man.

Na so Julian Alvarez shoot di freekick inside di Barcelona net just bifor halftime.

Bifor dat, Barcelona bin dominate di game wey dem create plenty chances wey Rashford, Cancelo bin miss.

Afta di break Barcelona try dia best to score through dia starboy Lamin Yamal - but dem no fit to score, na so Atletico get anoda chance later for di game to score; Alexander Sorloth score dat goal to make di tie difficult for Barcelona.

Afta di game dia coach Hansi Flick tok say di red card for Cubarsi na harsh one, wey im also question why di ref and VAR neva give Atletico defender Marc Pubill afta im use hand catch di ball when im keeper Musso pass di ball to am inside di box.

Hansi Flick say im team go "try to comeback for di second leg for di Metropolitano next week."

"We dey confident say we fit try, even for dis first leg, we don control di game wey we get plenty chances. We go give everitin for dat match for di second leg," Hansi Flick tok.

PSG sama Liverpool 2-0

Liverpool beat Galatasaray in the R16

Wia dis foto come from, JULIAN FINNEY/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Liverpool bin win seven of dia last 11 European matches against French teams but dem now dey face big task to overturn 0-2 first leg result for Anfield.

Liverpool coach Arne Slot say im team bin dey survival mode afta dem lose 0-2 to PSG for Paris on Wednesday.

PSG bin dominate di game from di beginning to di end, wey di reds neva even get one shot on target.

But Slot tok afta di game say im like di "fighting spirit" of di team, wey im hope say dem fit use dia home crowd to turn di game around next week.

Captain Virjil Van Dijk say di team neva go give up on dia champions league ambition despite di defeat.

"Make una no forget, PSG na di champions of last season, wey dem get plenty quality; but we gatz dey spot on for di second leg."

Goals from Desire Doue and Khvicha Kvaratskhelia give di Parisiens di advantage for di first leg even though dem fit score more goals inside dat game bifor.

Ousemane Dembele bin miss three chances to score for di game, wey Liverpool without Mohammed Salah, struggle throughout di game to get one shot on target.

Salah go comot di club at di end of di season but even di Egyptian no dey form anymore to create some magic.

For Liverpool, dis result mean say dem suffer two defeats for one week - 4-0 against Manchester City for di FA Cup wey dem collect 2-0 against PSG.

Slot go hope say di team fit respond next week, but for many football fans, PSG dey likely to still sama Liverpool for di second leg.

Bayern Munich carry 2-1 advantage to Allianz Arena to welcome Real Madrid

Bayern are arguably the most in-form team in Europe

Wia dis foto come from, ALVARO MEDRANDA/GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Real Madrid go hope to stage comeback for Allianz Arena next week against dia Bavarian opponent

Bayern Munich wey dey form travel to Bernebeu to sama Real Madrid 1-2 wit goals from Luis Diaz and Hary Kane.

Kylian Mbappe score one goal to reduce di deficit to 1-2 afta di German club bin dominate di game wit plenty chances.

Michael Olise wey shine well well for dat game get chance to score but im togeda wit Luis Diaz, Jamala Musiala bin miss dia chances to extend di lead for Bayern.

Olise tink say im gatz get penalty for di last minute when Alvaro Carreras bin push am for ground inside di box but di referee no gree award di penalty.

For Real Madrid, dem gatz blame diaserf as Vinicius bin miss two chances - wey Bayern Munich keeper Manuel Neuer make nine saves for di game to become man of di match.

Di game still dey open ahead of di second leg for Allianz Arena next week, as Real Madrid wey be record winners of di UCL (15), go hope to do dia tin on champions league nights.

Arsenal beat Sporting for Portugal

Premier league leaders Arsenal struggle wey dem get late goal to take 1-0 advantage comot Portugal to England for di second leg of di quarterfinal.

Sporting CP tink say dem bin get 0-0 draw for di game in front of dia fans, but substitute Kai Havertz bin get oda ideas.

Di German enta di game wey im score in added time afta Gabriel Martinelli bin play one fine pass thru di defence.

Arsenal goalkeeper David Raya wey be di man of di match make five saves to keep Arsenal for di game.

Di gunners kontinu dia unbeaten run for European competition against Sporting (W3 D3) wit dis result.

Di gunners go hope to revenge di time Sporting CP comot dem from two-leg game for Europe for di 2022/23 Europa league R16.

Sporting don win nine out of dia 10 Uefa competition wey be two-legs against English opponent, if dem fit do am again v Arsenal, dat go be 10 out of 11 wins against English opponent, but for di Emirates, na tough game.

Arsenal without Saka and Timber

Wia dis foto come from, DAVID PRICE/via GETTY IMAGES

Wetin we call dis foto, Sporting don win nine out of dia 10 Uefa competition wey be two-legs against English opponent.

Tuesday results

  • Real Madrid 1-2 Bayern Munich
  • Sporting CP 0-1 Arsenal

Wednesday results

  • PSG 2-0 Liverpool
  • Barcelona 0-2 Atletico Madrid

Second leg fixtures

Tuesday 14 April 2026

  • Atletico Madrid v Barcelona - 7PM GMT (8 PM WAT)
  • Liverpool v PSG - 7PM GMT (8 PM WAT)

Wednesday 15 April 2026

  • Arsenal v Sporting CP - 7PM GMT (8 PM WAT)
  • Bayern Munich v Real Madrid - 7PM GMT (8 PM WAT)