Easter Sunday celebration in pictures

Published

Christians all over di world dey celebrate di death and resurrection of Jesus Christ and Africa dey follow mark am.

Man wey hang for cross to symbolize Jesus for cross.
Wetin we call dis foto, Christians all over di world dey celebrate today as Easter Sunday.
Man wey dem cruxify for cross.
Wetin we call dis foto, For dem, di celebration na to mark di crucifixion, death and resurrection of Jesus Christ.
Actors perform di role of Jesus Christ and virgin Mary.
Wetin we call dis foto, African kontris no carri last as for di celebration. From South Sudan to Nairobi, di day dey special.
Man carry cross
Wetin we call dis foto, During di celebration, Christians dey act for drama wetin Jesus go through to remind demselves of wetin happun dat time.
Man for ground wey carry cruxifix.
Wetin we call dis foto, Actors perform di role of Jesus Christ during Good Friday wey mark di start of Celebrations.
Man carry cross
Wetin we call dis foto, Most times, some of di plays na churches dey organise am to teach dia members di importance of Easter celebration.
Christians for Nairobi act di death of Jesus Christ.
Wetin we call dis foto, Easter celebration na annual event for Christians.