WORLD CUP 2026
STADIUM GUIDE
WORLD CUP 2026
STADIUM GUIDE
Dis na guide to di 16 stadiums
for USA, Canada & Mexico
Di 2026 World Cup go be tournament like no oda. Dem go squeeze 104 ogbonge matches for inside just 39 days. Di tournament go spread across four time zones and three different countries. Some of di places wey dem go play far reach up to 2,800 miles from each oda.
To stage dis very big event, Fifa don select 16 host cities across North America, wey show some of di world most spectacular and iconic stadiums – from cutting-edge marvels like Los Angeles' record-breaking $5.5bn venue to Mexico City historic Estadio Azteca, wey be di scene of di World Cup finals for 1970 and 1986.
But these arenas no go only provide correct backdrop to di action – dem go also influence how far England and Scotland go go for di tournament.
Bad weather fit happen anywia, but wen Scotland go play Brazil for Miami, dem go almost surely face heavy heat and strong humidity wey go drain dia energy. Matches wey go happun for Monterrey sef fit also dey uncomfortable.
Conditions for Seattle and Vancouver, on di oda hand, suppose dey relatively cool, while di stadiums for Atlanta, Dallas and Houston go operate wit closed roofs and dem go use air condition, dis go take di weather out of di equation patapata. Altitude, meanwhile, don bicom factor for matches for Mexico City and Guadalajara.
Another consideration na say eight of di venues dey normally operate wit artificial turf. To meet Fifa requirements, dem don lay temporary grass surfaces for di duration of di World Cup. Dis go be di case for Atlanta, Boston, Dallas, Houston, LA, New Jersey, Seattle and Vancouver. Pipo don heavily condemn di Short-term pitches dem use for di 2025 Club World Cup, but Fifa don promise say dem go correct dos issues for dia showpiece event.
Fifa go also insist say make most stadiums temporarily adopt generic titles, wey mean to drop sponsors’ names. E fit take some time for fans of American football or Major League Soccer to get used to am, but venues like SoFi Stadium and Gillette Stadium go officially dey known as Los Angeles Stadium and Boston Stadium. To keep things simple, dem don include both di standard and Fifa-designated names for dis guide.
Even wit all di wahala wey dey ground — like traveling stress and di cost of tickets — assurance dey say dis tournament go sweet well‑well, weda you go watch am live for stadium or you just dey enjoy am for your house. Here na evritin you need to sabi about di stadiums and di cities.
Western Region
VANCOUVER - SEATTLE - SAN FRANCISCO - LOS ANGELES
BC Place Vancouver
Key facts:
- World Cup matches: 7
- Type: Retractable roof, temporary grass pitch
- Capacity: 48,821 (source - Fifa)
- Opened: 1983
- Time difference: -8 hours BST
- Average external daily high in June: 20C
Vancouver na di most northerly venue for dis tournament and e dey likely to provide di coolest conditions. Di stadium get infrared heating to make am more comfortable during di winter but air conditioning no dey, so dem go leave di retractable roof open during World Cup matches.
E dey known as BC Place becos na British Columbia provincial govment fund am and e go host seven fixtures for di 2026 tournament, wey include Canada second and third matches.
E bin stage di opening and closing ceremonies for di 2010 Winter Olympics plus nine games for di 2015 Women's World Cup, wey include di USA 5-2 win against Japan for di final.
Initially, e dey equipped wit one inflatable, domed roof but dem don replace am afta e tear for 2007 as snow begin gada. Di current roof, wey dey cable-supported and fully retractable, na di largest of im kind for di world, di stadium operators claim.
Date | Fixtures | Local |
13 June | Australia v Turkey | 9pm |
18 June | Canada v Qatar | 3pm |
21 June | Egypt v New Zealand | 6pm |
24 June | Switzerland v Canada | 12pm |
26 June | New Zealand v Belgium | 8pm |
2 July | Round of 32 | 8pm |
7 July | Round of 16 | 1pm |
You know say? Dem born and raise Hollywood stars Ryan Reynolds and Seth Rogen for Vancouver. Also, di cosmetic use of Botox start for dis city.
Seattle Stadium
(Lumen Field)
Key facts:
- World Cup matches: 6
- Type: Outdoor, temporary grass pitch
- Capacity: 65,123 (source - Fifa)
- Opened: 2002
- Time difference: -8 hours BST
- Average daily high in June: 22C
Located 100 miles south of di land border wit Canada for di Pacific Northwest, Seattle na US venue least likely to experience extreme heat.
Di stadium get horseshoe shape, and di north side open well‑well, so you fit dey see di fine views of di downtown skyscrapers. Na there NFL team wey dem dey call Seattle Seahawks dey use as dia base, dem build am on di site of dia old stadium, Kingdome.
Also, di stadium don serve as Seattle Sounders' home since dem bicom MLS expansion franchise for 2009, while di women's side Seattle Reign don dey play for there since 2022, wit di high usage wey mean say dem dey normally use artificial turf.
Dem put one temporary grass pitch about 10 days bifor 2025 Club World Cup, but e no really work well for di tournament. Di grass quick dry becos e no dey deep enough to hold water, wey make PSG coach Luis Enrique complain say di ball dey bounce “like rabbit” afta dem play match for there.
Di pitch wey dem go use for di World Cup suppose beta pass di previous ones. Work bin start for late February and dem complete am for mid-April. Dem first put one strong base wey be like 12 inches deep, made of sand plus oda materials, on top di artificial turf. Dem first put one strong base wey be like 12 inches deep, made of sand and other materials, on top the artificial turf. Afta dat, dem come lay fresh grass (sod) on top, so to water di pitch no suppose be problem again.
Di Sounders, Reign and US women’s team don already play on di new pitch, and e get plenty positive feedback. Dem go play six World Cup games for Seattle, including di USA second group match.
Date | Fixtures | Local |
15 June | Belgium v Egypt | 12pm |
19 June | USA v Australia | 12pm |
24 June | Bosnia-Herzegovina v Qatar | 12pm |
26 June | Egypt v Iran | 8pm |
1 July | Round of 32 | 1pm |
6 July | Round of 16 | 5pm |
You know say?Dem name Seattle afta Chief Seattle, one Native American leader wey promote peace and co-operation wit settlers for di 19th century.
San Francisco Bay Area Stadium
(Levi's Stadium)
Key facts:
- World Cup matches: 6
- Type: Outdoor, permanent grass pitch
- Capacity: 69,391 (source - Fifa)
- Opened: 2014
- Time difference: -8 hours BST
- Average daily high in June: 24C
Though home to five-time Super Bowl winners di 49ers, dis stadium tanda 35 miles south-east of San Francisco for Santa Clara, for di heart of Silicon Valley and part of di Bay Area conurbation.
Di cost to build am reach $1.3bn but most of di part no dey covered. Dis one make fans dey exposed to di elements come rain or shine. To add roof or shade no dey feasible as building height restrictions dey in place for there becos San Jose airport dey nearby.
Strong sunlight go particularly affect di eastern side of di stadium, but most World Cup matches go kick off later in di day.
Dem spend like $200m to take renovate di project, and dem finish am for summer 2025. Di work make drainage and air flow for di pitch beta, plus dem adjust di corner seats so e go fit FIFA standard pitch size.
In addition to staging World Cup games for 2026, di venue bin host dia second Super Bowl for February.
Date | Fixtures | Local |
13 June | Qatar v Switzerland | 12pm |
16 June | Austria v Jordan | 9pm |
19 June | Turkey v Paraguay | 8pm |
22 June | Algeria v Jordan | 8pm |
25 June | Paraguay v Australia | 7pm |
1 July | Round of 32 | 5pm |
You know say?Di stadium get im own rooftop farm wia dem dey grow organic vegetables and herbs, wey dem dey use for di food stalls and restaurants.
Los Angeles Stadium
(SoFi Stadium)
Key facts:
- World Cup matches: 8
- Type: Indoor/outdoor hybrid, temporary grass pitch
- Capacity: 69,650 (source - Fifa)
- Opened: 2020
- Time difference: -8 hours BST
- Average daily high in June: 24C
Dis ultra-modern design arguably na di most impressive venue for di 2026 World Cup - dis one no come as surprise as report say e cost $5.5bn to make am comfortably di most expensive stadium ever built.
Na one kind special indoor/outdoor stadium be dis. Dem cover di stadium plus di area wey dey beside am wit one big transparent canopy wey spread pass 90,000 square metres. Na 37 strong pillars wey fit stand earthquake hold am, and di whole place still open for three sides so fresh air go fit dey enta freely.
One gigantic 4K videoscreen, wey weigh nearly 1000 tonnes, dey suspended from di roof. Becos e get oval-shaped and double-sided, fans fit see The Infinity Screen, e no mata wia dem sit down.
Di stadium dey located for Inglewood, about three miles from di city main airport. Becos of height restrictions, builders no fit go too high, so dem dig ground well‑well — ova five million cubic metres — to put di pitch about 30 metres underground. Dis one mean say, some fans go need to go down bifor dem reach dia seat.
Di stadium na home to LA two NFL franchises, di Rams and Chargers. E also host di Super Bowl for 2022, wia di Rams win to bicom di second team to lift di Vince Lombardi Trophy for dia own stadium.
Date | Fixtures | Local |
12 June | USA v Paraguay | 6pm |
15 June | Iran v New Zealand | 6pm |
18 June | Switzerland v Bosnia-Herzegovina | 12pm |
21 June | Belgium v Iran | 12pm |
25 June | Turkey v USA | 7pm |
28 June | Round of 32 | 12pm |
2 July | Round of 32 | 12pm |
10 July | Quarter-final | 12pm |
You know say?Di venue for Los Angeles na di newest for di 2026 World Cup and e go stage USA first and third group matches, e go also co-host di opening ceremony for di 2028 Olympics.
CENTRAL REGION
GUADALAJARA - MEXICO CITY - MONTERREY - HOUSTON - DALLAS - KANSAS CITY
Guadalajara Stadium
(Estadio Akron)
Key facts:
- World Cup matches: 4
- Type: Outdoor, permanent grass pitch
- Capacity: 44,330 (source - Fifa)
- Opened: 2010
- Time difference: -7 hours BST
- Average daily high in June: 28C
Dis stadium na home to Club Deportivo Guadalajara. Dis venue go only host four World Cup matches, one joint low wit Monterrey, and e include Mexico second match.
Di stadium siddon on top one artificial hill and dem design am to resemble volcano, wit red seating evoking di crater and a white roof - e dey supported by 16 pillars - wey appear to float like a cloud above di lava.
Di 2026 tournament go happun di same time wen rainy season dey start for Guadalajara, and most of di rain wey dem dey get evri year dey fall between June and September. Pipo reason am as Mexico second biggest city, and e lie for altitude of ova 1,600 metres — wey fit make some players tire quick‑quick.
Date | Fixtures | Local |
11 June | South Korea v Czech Republic | 8pm |
18 June | Mexico v South Korea | 7pm |
23 June | Colombia v DR Congo | 8pm |
26 June | Uruguay v Spain | 6pm |
You no say?Dis stadium dey located eight miles west of di city oda main ground, Estadio Jalisco, wey be di scene of Gordon Banks' wonder-save from Pele for 1970 and Josimar ogbonge long-range goal for Brazil versus Northern Ireland for 1986. Anoda venue for di city, Estadio Tres de Marzo, bin also host matches for di latter tournament.
Mexico City Stadium
(Estadio Azteca)
Key facts:
- World Cup matches: 5
- Type: Outdoor, permanent grass pitch
- Capacity: 72,766 (source - Fifa)
- Opened: 1966
- Time difference: -7 hours BST
- Average daily high in June: 24C
Dis historic ground go bicom di first stadium wey go stage matches for three men's World Cups wen e host di opening game of di 2026 tournament, just as e happun for 1970 and 1986.
Di Azteca na di scene of Diego Maradona two goals against England for 1986 – di first na di 'Hand of God' – and Argentina subsequent win for di final. Di stadium na also wia Brazil bin lift di Jules Rimet Trophy afta dem beat Italy for 1970.
Mexico national team, Club America and Cruz Azul dey normally use am. Even though all di three clubs bin dey forced to play for anoda place wen major renovations start for May 2024. Di stadium reopen for March 2026 for one friendly between Mexico and Portugal but di occasion no jolly again wen one fan die afta e fall from one upper level.
Becos Mexico city dey about 2,200 meters above sea level, di city no place no dey too hot like oda World Cup host cities for di kontri. Although, most time, air pollution for there na problem. Di thinner air go test players stamina, e go also make ball travel faster and go farther pass normal, compared to places wey dey sea level.
Date | Fixtures | Local |
11 June | Mexico v South Africa | 1pm |
17 June | Uzbekistan v Colombia | 8pm |
24 June | Czech Republic v Mexico | 7pm |
30 June | Round of 32 | 7pm |
5 July | Round of 16 | 6pm |
You know say? Mexico City dey sink by up to 40cm a year. Dat na becos dem build am on di soft clay bed of one ancient lake - wey one time be di site of di Aztec capital, Tenochtitlan - wey dem drain afta di Spanish conquest.
Monterrey Stadium
(Estadio BBVA)
Key facts:
- World Cup matches: 4
- Type: Outdoor, permanent grass pitch
- Capacity: 50,113 (source - Fifa)
- Opened: 2015
- Time difference: -7 hours BST
- Average daily high in June: 34C
Dis stadium get fine, eye-catching environment as e dey under di shadow of Cerro de la Silla, one big mountain wey reach about 1,800 meters high and dey dominate everywia. Di stadium na home to five-time Mexican champions Monterrey, wey don play for there since e open for 2015.
Monterrey na major industrial hub 90 miles from di US border and e go likely be among di hottest host cities for di 2026 World Cup.
Temperatures for June dey normally reach 34C, but one deadly heatwave for 2024 bin see di mercury pass 40C. For dat reason, no game for dis summer go start bifor 7pm local time.
Date | Fixtures | Local |
14 June | Sweden v Tunisia | 8pm |
20 June | Japan v Tunisia | 10pm |
24 June | South Africa v South Korea | 7pm |
29 June | Round of 32 | 7pm |
You know say?Di last World Cup game for Monterrey na Mexico penalty shoot-out defeat by West Germany for di quarter-finals for 1986. Di city bin host eight fixtures for dat tournament, split between two venues, wey include all three of England group matches.
Houston Stadium
(NRG Stadium)
Key facts:
- World Cup matches: 7
- Type: Retractable roof, temporary grass pitch
- Capacity: 68,311 (source - Fifa)
- Opened: 2002
- Time difference: -6 hours BST
- Average external daily high in June: 33C
Dis stadium na home to di Houston Texans. Di venue bicom di first NFL stadium wey get retractable roof wen e open for 2002. Dem build am at a cost of $352m, e also feature climate control – sake of di hot and humid outdoor conditions wey dey expected for June and July.
Di stadium bin initially get grass pitch but dem replace am wit artificial turf for 2015, so dem go install one temporary natural playing surface for di World Cup. Although, e dey known as NRG Stadium since 2014, but dem go remove dat branding dis summer, and wen di NFL season resume for September, dem go change am to im original title – Reliant Stadium.
Dem don use dis venue for football on plenty occasions, wey include Mexico win against USA for di 2025 Gold Cup final plus Copa America matches for 2016 and 2024. Di stadium don also host two Super Bowls, wey Tom Brady New England Patriots win but no fit ever forget for different reasons.
Janet Jackson breast bin show small during di Super Bowl halftime show for 2004, while Tom Brady lead di Patriots to do one of di biggest comeback for Super Bowl history for 2017—dem come from 28–3 down come beat Atlanta Falcons for overtime.
Date | Fixtures | Local |
14 June | Germany v Curacao | 12pm |
17 June | Portugal v DR Congo | 12pm |
20 June | Netherlands v Sweden | 12pm |
23 June | Portugal v Uzbekistan | 12pm |
26 June | Cape Verde v Saudi Arabia | 7pm |
29 June | Round of 32 | 12pm |
4 July | Round of 16 | 12pm |
You know say: Work to install grass pitch bin start afta di stadium host Houston annual livestock and rodeo show for March. 2.6m pipo attend di three-week event dis year and na di largest of im kind for di world.
Dallas Stadium
(AT&T Stadium)
Key facts:
- World Cup matches: 9
- Type: Retractable roof, temporary grass pitch
- Capacity: 70,122 (source - Fifa)
- Opened: 2009
- Time difference: -6 hours BST
- Average external daily high in June: 33C
Dis state‑of‑the‑art stadium, wey get air condition to reduce Texas hot weather, go host more games pass any oda venue for di 2026 World Cup. Organisers bin first reason say na im go be di front-runner for di final, but dem later chose New Jersey. E go still host di tournament first semi-final match.
Di stadium na di base of five-time Super Bowl winners Dallas Cowboys, wey dem nickname 'America's team' and dey ranked as di most valuable sport team for di world.
E dey located for Arlington, 17 miles west of downtown Dallas, di stadium cost $1.2bn to build, dem spend additional $295m spent on renovations ahead of di World Cup.
Becos NFL field dey smaller—about 20m narrower—pass FIFA standard dimensions, dem go raise di pitch to create more space, dem go also install temporary natural grass surface for inside.
Sake of im big size and strikingly futuristic shape, pipo don compare di stadium to di Death Star for Star Wars and just like di fictional superweapon, e get notable flaw.
During NFL games, di evening sun dey enta through big windows for one side of di stadium and e dey disturb players. Although, di owner wey be Cow boy billionaire Jerry Jones no dey too like tok about am and e no gree make dem use blackout curtains during Dallas' games. However, tori say dem go use curtains to block glare for di World Cup match between Japan and Sweden on 25 June, wey go end wen di sun dey set.
Cowboys home games na di one pipo dey attend pass for di NFL, e dey get average attendance of more dan 90,000, wey include some fans wey buy cheap tickets. However, for di World Cup, di stadium go complete sitting arrangement (all-seater), so di capacity go reduce well-well, e no go reach dat usual huge number again.
Date | Fixtures | Local |
14 June | Netherlands v Japan | 3pm |
17 June | England v Croatia | 3pm |
22 June | Argentina v Austria | 12pm |
25 June | Japan v Sweden | 6pm |
27 June | Jordan v Argentina | 9pm |
30 June | Round of 32 | 12pm |
3 July | Round of 32 | 1pm |
6 July | Round of 16 | 2pm |
14 July | Semi-final | 2pm |
You know say?Di stadium big well-well, New York Statue of Liberty - wey dey 93m high - go fit inside it, even if dem close di roof.
Kansas City Stadium
(GEHA Field at Arrowhead Stadium)
Key facts:
- World Cup matches: 6
- Type: Outdoor, permanent grass pitch
- Capacity: 67,513 (source - Fifa)
- Opened: 1972
- Time difference: -6 hours BST
- Average daily high in June: 30C
Kansas City location for America Midwest fit make am look like one of di less flashy host cities for di 2026 World Cup, but 'KC' get strong football history and culture, plus dem get one of di most unique and lively stadiums for US. Something wey go bring different vibe compared to di many ultra-modern stadiums wey go host matches for di tournament.
Pipo sabi am as Arrowhead Stadium, dem launch dis open-air bowl for 1972 and e get strong history. Di stadium na home to four-time Super Bowl winners, di Kansas City Chiefs. Na di third oldest ground wey NFL team currently dey use. For 2010, dem carry out major renovation, dem complete di renovation project wit $375m.
Another plus na di low cost of transportation go di stadium. On match days, buses go carry fans go and come back from Arrowhead for around $15, well cheap well-well. Also, free shuttle bus dey to carry visitors from di airport go di city centre.
Kansas City metropolitan area spread enta Missouri and Kansas, but most part of di city — wey include Arrowhead Stadium — dey for Missouri side (east). Last December, di Chiefs bin announce plans to relocate to one new £3bn domed stadium, wey dem wan build across di state border in Kansas, for 2031. Dis decision don put Arrowhead Stadium for risk, becos once di Chiefs comot, di stadium fit face demolition.
E dey popular for di ogbonge sound e dey produce, dem purposely design am to make crowd noise loud well-well and dem direct di sound to di field.
Date | Fixtures | Local |
16 June | Argentina v Algeria | 8pm |
20 June | Curacao v Ecuador | 7pm |
25 June | Tunisia v Netherlands | 6pm |
27 June | Algeria v Austria | 9pm |
3 July | Round of 32 | 8.30pm |
11 July | Quarter-final | 8pm |
You know say?For 2014, Chiefs fans bin set Guinness World Record for di loudest noise at a sports stadium, e generate 142.4 decibels – dem compare am to di noise wey dey come wen pesin stand 30m from a jet engine.
EASTERN REGION
ATLANTA - MIAMI - TORONTO - BOSTON - PHILADELPHIA - NEW YORK
Atlanta Stadium
(Mercedes-Benz Stadium)
Key facts:
- World Cup matches: 8
- Type: Retractable roof, temporary grass pitch
- Capacity: 67,382
- Opened: 2017
- Time difference: -5 hours BST
- Average external daily high in June: 30C
Dem build dis stadium wit about $1.6bn. Dis ogbonge, air-conditioned venue get retractable oval roof wey dem design wit eight big petals wey dey overlap. Dis roof fit open and close like camera aperture, wey dey give di venue very unique look and feel.
Architects say di design take inspiration from di Pantheon for Rome, wey also dey allow natural light to enta through one circular opening for di top of dia dome. da thing wey make di stadium standout na one giant 360-degree wrap-around 'halo' video screen. Di screen dey about 327m long and e dey use ova 37 million LEDs.
Di stadium dey normally known as Mercedes-Benz Stadium, but becos FIFA no dey allow sponsored names for venues, e go use general name during di World Cup — just like most of di 2026 host stadiums. Atlanta go host eight games, wey include di tournament second semi-final.
Normally, dem dey use artificial turf for di stadium, but to meet Fifa requirements, dem go install temporary grass surface, dem go also do di same thing for Boston, Dallas, Houston, Los Angeles, New Jersey, Seattle and Vancouver.
Di stadium, wey be di base for NFL team Atlanta Falcons and MLS club Atlanta United, get one special advantage ova many venues for US becos of di location — e dey right inside di heart of di city, instead of di outskirts.
Date | Fixtures | Local |
15 June | Spain v Cape Verde | 12pm |
18 June | Czech Republic v South Africa | 12pm |
21 June | Spain v Saudi Arabia | 12pm |
24 June | Morocco v Haiti | 6pm |
27 June | DR Congo v Uzbekistan | 7.30pm |
1 July | Round of 32 | 12pm |
7 July | Round of 16 | 12pm |
15 July | Semi-final | 3pm |
You know say? Di Falcons dey pride demsefs on di reasonable price of food and drink for dia stadium. Normally, Hot dogs na just $2, and one small bottle of beer cost only $5. Team owner Arthur Blank bin promise for May say dem no go increase di prices for di World Cup. E say “fans dey ginger us, dem dey bring dia energy… and we gatz honour dat”.
Miami Stadium
(Hard Rock Stadium)
Key facts:
- World Cup matches: 7
- Type: Outdoor, permanent grass pitch
- Capacity: 64,091 (source - Fifa)
- Opened: 1987
- Time difference: -5 hours BST
- Average daily high in June: 31C
Miami na di US venue wia weather be di biggest concern. Heat and humidity high for there well-well, and dis one mean say, di condition fit make am uncomfortable for both di fans wey dey watch di football and di players wey dey pitch, as di hot weather fit affect performance and overall experience for June and July.
While di climate for Atlanta, Houston and Dallas fit dey similarly oppressive, di World Cup stadia there go get closed roofs and air conditioning, but Miami no get dat option as na open-air stadium.
To protect players’ health, dem don arrange say no match go start bifor 5pm, even though di weather still fit affect di game. During di opening game of di 2025 Club World Cup, di match bin start at 8pm local time for Miami, wen di temperature still be 28C.
Di stadium dey about 13 miles north of di city centre, na home to di Miami Dolphins and e don host six Super Bowls. Evri year, dem dey host di Miami Open tennis tournament inside di stadium, and since 2022, Formula 1 Grand Prix dey happun for one temporary race track wey dem build around di stadium area.
Date | Fixtures | Local |
15 June | Saudi Arabia v Uruguay | 6pm |
21 June | Cape Verde v Uruguay | 6pm |
24 June | Scotland v Brazil | 6pm |
27 June | Colombia v Portugal | 7.30pm |
3 July | Round of 32 | 6pm |
11 July | Quarter-final | 5pm |
18 July | Third-place play-off | 5pm |
You know say?Miami na di scene of di chaotic Copa America final between Argentina and Colombia for 2024, dem delay di match for 80 minutes afta fans wey no get ticket force dia way inside di stadium.
Toronto Stadium
(BMO Field)
Key facts:
- World Cup matches: 6
- Type: Outdoor, permanent grass pitch
- Capacity: 44,315 (source - Fifa)
- Opened: 2007
- Time difference: -5 hours BST
- Average daily high in June: 23C
Canada national team don play almost half of dia home games for dis stadium since dem launch am and dem go start dia World Cup campaign for there on 12 June bifor dem switch go Vancouver for di remaining two group matches.
Located on di western shore of Lake Ontario, dem build di stadium as venue for di 2007 Fifa Under-20 World Cup and to provide a home for Toronto FC, wey later bicom MLS expansion side dat same year. Na also di base for di Toronto Argonauts, wey dey play for di Canadian Football League ( wey dey similar to di NFL).
Dem don upgrade di capacity of di stadium for di World Cup, as dem add 17,000 temporary seats to di stadium north and south stands through steep scaffolding – E fit dey scary for anybody wey dey fear heights. Some fans wey bin siddon for there during MLS games bin tok say dem feel say di place dey shake wen strong wind blow.
Date | Fixtures | Local |
12 June | Canada v Bosnia-Herzegovina | 3pm |
17 June | Ghana v Panama | 7pm |
20 June | Germany v Ivory Coast | 4pm |
23 June | Croatia v Panama | 7pm |
26 June | Senegal v Iraq | 3pm |
2 July | Round of 32 | 7pm |
You know say?Di stadium dey a few miles away from di city most famous landmark — di CN Tower, wey high reach about 553 metres. Na di tallest freestanding structures for di world untill anoda one pass am for 2007.
Boston Stadium
(Gillette Stadium)
Key facts:
- World Cup matches: 7
- Type: Outdoor, temporary grass pitch
- Capacity: 63,815 (source - Fifa)
- Opened: 2002
- Time difference: -5 hours BST
- Average daily high in June: 26C
Dis stadium na home to six-time Super Bowl winners New England Patriots and MLS side New England Revolution. Dis open-air venue dey for di town of Foxborough, 20 miles south-west of Boston. To make dat kain journey, usually dey cost $20 for a return rail ticket but dem don increase di price to $80 for World Cup fans.
Even though di stadium don pass 20 years, dem renovate am for 2023 wit about $250m to upgrade am. As part of di redesign, dem add one big 66‑metre artificial lighthouse wey dey overlook di stadium — something wey connect am to Massachusetts maritime history. According to di stadium operators, dem claim say di stadium na USA tallest "non-traditional" lighthouse.
One bronze statue of legendary former Patriots quarterback Tom Brady dey erected next to di lighthouse for August 2025.
Di venue host four games for di Women's World Cup for 2003 and dem build am on di same site as di Foxboro Stadium wey dem demolish now, wey host six men's matches for 1994.
Date | Fixtures | Local |
13 June | Scotland v Haiti | 9pm |
16 June | Iraq v Norway | 6pm |
19 June | Scotland v Morocco | 6pm |
23 June | England v Ghana | 4pm |
26 June | France v Norway | 3pm |
29 June | Round of 32 | 4.30pm |
9 July | Quarter-final | 4pm |
You know say? Foxboro na di scene of Diego Maradona infamous
eye-bulging celebration afta e score for Argentina for USA '94, few days bifor e fail drug test.
Philadelphia Stadium
(Lincoln Financial Field)
Key facts:
- World Cup matches: 6
- Type: Outdoor, permanent grass pitch
- Capacity: 65,827 (source - Fifa)
- Opened: 2003
- Time difference: -5 hours BST
- Average daily high in June: 28C
2025 Super Bowl winners Philadelphia Eagles use dis open-air venue and e dey considered one of di most environmentally friendly stadiums for di NFL.
E get more dan 10,000 solar panels, wey dey generate enough electricity to cover about one‑third of di stadium yearly power use.
Fans of di Eagles dey call di stadium “The Linc”. E be part of di South Philadelphia Sports Complex, wey cover about 260-acres. For dat same area, you go also see di city baseball team stadium, plus one indoor arena wey Philadelphia basketball, ice hockey and lacrosse teams dey share. Dis make di place one major sports hub for di city.
Date | Fixtures | Local |
14 June | Ivory Coast v Ecuador | 7pm |
19 June | Brazil v Haiti | 8.30pm |
22 June | France v Iraq | 5pm |
25 June | Curacao v Ivory Coast | 4pm |
27 June | Croatia v Ghana | 5pm |
4 July | Round of 16 | 5pm |
You know say?Philadelphia na wia dem take adopt di Declaration of Independence for 1776 - 250 years on. Di city go host a World Cup round of 16 game on 4 July as part of USA semiquincentennial celebrations.
New York New Jersey Stadium
(MetLife Stadium)
Key facts:
- World Cup matches: 8
- Type: Outdoor, temporary grass pitch
- Capacity: 78,576 (source - Fifa)
- Opened: 2010
- Time difference: -5 hours BST
- Average daily high in June: 27C
Dis big, mostly open stadium get di biggest capacity of all di venues wey go host matches for dis World Cup. E even beat strong competition from Dallas to win di right to host di final match.
E dey located for East Rutherford, New Jersey, but na only five miles from Manhattan, which na why Fifa go for di somewhat cumbersome title of New York New Jersey Stadium.
Return journey from Manhattan Penn Station dey usually cost about $12.90, but during di World Cup, fans go pay around $98 for dat same trip. However, shuttle buses wey go operate from oda central locations go dey available wey go cost around $20 for return trip,
Di stadium na home for NFL teams, di Giants and Jets, and dem spend about $1.6bn to build am. At first, dem bin plan to add retractable roof, but dem quickly drop dat idea sake of di high cost plus dia budget no reach.
Di stadium artificial turf get poor reputation, as plenty NFL stars suffer serious injuries on di surface. Giants wide receiver Malik Nabers bin tear im anterior cruciate ligament there for September, wey make am bicom di latest player to fall victim to di so-called 'MetLife curse'.
Many of di league players and coaches believe say natural field go dey safer but plans no dey to keep di temporary grass pitch dem go install for di duration of di World Cup.
Date | Fixtures | Local |
13 June | Brazil v Morocco | 6pm |
16 June | France v Senegal | 3pm |
22 June | Senegal v Norway | 8pm |
25 June | Ecuador v Germany | 4pm |
27 June | Panama v England | 5pm |
30 June | Round of 32 | 5pm |
5 July | Round of 16 | 4pm |
19 July | Final | 3pm |
You know say? Dem construct di venue immediately adjacent to di Giants Stadium wey dem don demolish now. E host seven World Cup games for 1994, wey include di Republic of Ireland famous win against Italy, plus Pele final match for 1977.
Credits
Written by Tom McCoy
Sub-edited by Scott Reid and Joe Rimmer
Graphics by Andy Dicks
Images by Getty Images