Similar cases of women like Wendy Achumba wey die for similar circumstances as police gbab two men for her death

Salome, Uwavera, Wendy, and Yetunde

Wia dis foto come from, Salome Adaidu/Uwavera Omozuwa/Facebook/Vee_baby03/TikTok/Sikirulai Ande

Published
Read am in 6 mins

Di Imo State Police Command don arrest two men wey dem suspect say get hand inside di alleged rape and murder of 21-year-old Wendy Achumba for Obowo Local Govment Area of di state.

Wendy Achumba bin dey go school to bicom nurse for di Mercy College of Nursing Science for Umulogho bifor dem find her deadi bodi for her private off campus house for Umuadara, Umulogho.

Police bin reveal say di suspects come from di same place wit di victims.

Dem gbab dem afta intelligence led investigations wey police run on collabo wit di community.

Di Imo State Police command tok-tok pesin, Henry Okoye, say di first batch of investigations bin link di suspects to di incident and one of dem allegedly bin confess to di crime.

Okoye tok say dem dem don carry di suspects give State Criminal Investigation Department for more investigation and possible prosecution.

Ova di years, Nigeria don see many high profile cases of rape and murder some of dem still dey provoke reactions till today since dem neva close di cases.

Bamise Ayanwola and di BRT driver

Collage foto of Bamise Ayanwola and BRT bus

Wia dis foto come from, Facebook/Bamise Ayanwola/BBC

For 26 February, 2022, Bamise Ayanwola bin enta BRT bus to go from Lekki go Oshodi to see her senior brother, Pelumi.

She no reach her destination dat day wey make her family raise alarm.

Her sister claim say Bamise bin dey chat wit her friend wen she sense danger inside di boss. She say she even send pictures and videos bifor her phone disconnect.

Bifor dem declare di 22-year-old lady missing, she bin enta BRT bus for Lekki. Wen she notice say somtin fit happun to her inside di BRT bus, Bamise chat wit her friends, send voice notes and video to her.

She tok say "na three men and one woman dey inside di bus. Di woman sidon for back".

Zooming-in di phone camera she say "dat na di number of di bus just in case. Please pray for me".

E take about a week bifor police find her deadi bodi along Carter Bridge for Lagos Island.

Police say dem arrest di suspect on Monday afta dem find di bodi for Carter Bridge, Lagos Island.

By di Monday afta dem find her bodi, dem arrest di main suspect wey be 47 years old BRT driver, Andrew Nice.

By May 2025, dem find am guilty of di rape and murder of Bamise wey bin dey work as fashion designer and sentence am to death by hanging.

In fact, dem find out say e bin also dey accused say im rape two oda women wey dem call Maryjane Odezulu and Dr Anosike..

Iniubong Umoren and job seeking murder

Iniubong Ephraim Umoren

Wia dis foto come from, Umoh Uduak

For April 2021, one of Iniubong Umoren friend raise alarm for social media say she dey miss.

Iniubong Ephraim Umoren wey be graduate of Philosophy from di University of Uyo bin go online on April 27, to appeal for job, but she fall into di wrong hands. For her pinned post on Twitter wey she post on 27 April, she say she dey find work.

On 29 April, Umoh Uduak, her friend begin use #HinyNumoren to announce say her friend dey in trouble and she need help.

Uduak wey her X handle (formerly Twitter) be @HappinessActivist say her friend tell her say she dey go for one job interview for Airport Road, Uyo, Akwa Ibom State, and she no return since den.

She say di interview venue dey veri far from her house. She add say she bin send her one second audio record and as she try call her back, na her scream she hear. Plenty X users chook mouth to find her.

Dis come make police for Akwa Ibom State begin investigate di mata and arrest one Uduak-Abasi Akpan afta dem find Iniobong Umoren dead for one shallow grave for im house for Uyo, Akwa Ibom State capital.

Di Police arrest 20 years old Uduak Frank Akpan for di suspected kidnap, rape and murder of Miss Umoren.

For August 2022, Akwa Ibom State High Court sentence Uduak to death by hanging.

Yetunde Lawal and her online lover

Yetunde Lawal

Wia dis foto come from, SIKIRULAI ANDE

For February 2025, police for Kwara State, southwest Nigeria, bin confam say dem arrest one 29-year-old man, Abdurahman Bello wey allegedly kill and pieces di bodi of one 23-year-old female student of Kwara State College of Education, Ilorin, Yetunde Lawal.

Tok-tok pesin for di state police, SP Adetoun Ejire-Adeyemi, tell BBC News Pidgin say di name of di victim na Yetunde Lawal.

High Court for Kwara bin sentence Bello to death by hanging.

Na Justice Hannah Ajayi sentence di accused pesin on Wednesday 31 July afta she find am guilty of di crime.

‎Justice Ajayi say evidence prove say Bello kill Yetunde so e go fit use am for money ritual and sell her parts.

‎According to di judge, di confession of love and plan to marry her na lie wey e tell am so e go fit invite am to im house to kill am.

Justice Ajayi set four suspects free afta she find dem not guilty.

Salome Adaidu and Timileyin Ajayi

Salome Adaidu

Wia dis foto come from, Salome Adaidu/Facebook

Friends on social media bin mourn di death of Salome Adaidu wey her boyfriend cut her head for Nasarawa State, north-central Nigeria.

Dem gbab Timileyin Ajayi wey be gospel singer wit Adaidu head on Sunday 12 January 2025 near one church for Orozo.

One video wey go viral on social media show as pipo surround Ajayi wen dem gbab am and begin ask am question about di human head and di lady wey be corps member.

She tok say Adaidu na im girlfriend and add say dem don dey date for about one year.

Police for Nasarawa confam di incident to BBC News Pidgin and add say dem find di remains of di victim wey don dey cut into pieces for im house.

Di High Court for Lafia, Nasarawa State, bin sentence Oluwatimileyin Ajayi to death by hanging for di death of Adaidu.

Na Justice Simon Aboki wey preside ova di case sentence di suspect.

Di judgment find Oluwatemileyin Ajayi guilty of killing and dismembering (cutting to pieces) di late Salome Adaidu.

Uwavera Omozuwa and di church alleged rape

Uwavera Omozuwa

Wia dis foto come from, uwavera omozuwa/facebook

Uwavera Omozuwa na di 22-year-old Microbiology student of University of Benin wey some bad pipo attack and rape inside one Redeemed Christian Church of God for Ikpoba Hill, Edo State, south-south Nigeria, for 20, May 2020.

Report say Uwa bin go read inside di church, wen di attack happun and three days later she come die for hospital.

BBC News Pidgin reach out to Uwavera elder sister, Judith, wey give us di load down of wetin happun.

"My sister bin go church for morning to read. She dey always go dia to read even bifor she gain admission for university becos e dey quiet.

"Around afta 6pm, my mama receive call from one of di church members say make we come o say dem no know wetin dem do my sister. One of di women wey find my sister say wen dem see her, her skirt and pant don tear and her shirt dey soaked wit blood," she tok.