South Africa President Ramaphosa to face parliament afta e no gree resign

Wia dis foto come from, Ziyaad Douglas/Gallo Images via Getty Images
South African President Cyril Ramaphosa go face di kontri parliament on Thursday wia e dey expected to come unda fire by opposition members.
Dis na di first time oga Ramaphosa go face di lawmakers since one court for di kontri rule say dem suppose set up process to determine weda to impeach di president.
Kwesions about di ruling by di Constitutional Court no dey on di list, according South Africa SABC News, but some opposition lawmakers fit try to bring up di matter during follow-up kwesion.
Ramaphosa go mostly tok about issues like di 'Operation Prosper', wey be military operation to clear communities wia criminal gangs dey disturb and oda places wia pipo dey engage for illegal mining.
E go also tok about di procedure e bin follow to suspend di National Police Commissioner, Fannie Masemola, plus wetin govment dey do about di rising unemployment.
Di South African president dey face di National Assembly to answer kwesions on important govment policies and actions, at least once evri quarter.
On Friday 8 May 2026, di South Africa Constitutional Court bin rule say di National Assembly no do well wen dem vote for December 2022 to dismiss di Section 89 of di independent panel report wey concern Ramaphosa 'Phala Phala' scandal.
Di 'Phala Phala' or 'Farmgate' scandal refer to di mata wey one former South African spy boss, Arthur Fraser, bin file wit police, wia e bring accuse say tiff pipo bin attack Ramaphosa farm for Phala Phala in 2020, and tiff about $4m in cash, but di president cover di incident.
To hold dat kain amount of money for cash dey illegal for South Africa, but President Ramaphosa, though e agree say di theft bin hapun, e tok say di amount wey dem tif na just about $580,000, wey be moni im bin make from selling one buffalo for im farm.
E also deny say e cover up di mata.
Afta di ruling on Friday, opposition leaders, including controversial politician Julius Malema of di Economic Freedom Fighters (EFF), call on Ramaphosa to resign.
Malema say di President suppose "concentrate on dis impeachment process because e get serious implications on him as an individual."
But di presidency issue statement to say Ramaphosa no dey fear to subject imsef to due process.
Den Ramaphosa imsef tok days later say e no go resign.
"I wan make am clear say I no dey resign," e tok. "To do so go be to abandon di responsibility wey I assume wen I become President of the Republic."








