Ghanaian actor Seth Kwame die at age 51

Wia dis foto come from, Seth Kwame Dzokoto
Ogbonge Ghanaian actor, media personality and politician Seth Kwame Dzokoto don die at di age of 51.
E die on Thursday, 22 October, afta e collapse during one live show, Owass fm, di radio station wia e dey work confam im death on dia official Facebook page.
For inside statement wey di Owass fm management sign, dem say Dzokoto die afta one medical emergency during one live morning show discussion for di station earlier today.
"Hon. Seth Kwame Dzokoto bin dey participate for one panel discussion on our morning show "Oman Nkoso" wen e suddenly bicom and collapse.
"Our team immediately rush am go hospital for medical attention. Sadly, as dem reach di hospital, attending medical doctor pronounce am death," di statement read.
Di station say dem dey deeply sad sake of dis "unfortunate" incident, as dem tok sorry to im family, loved ones and colleague's wey im passing affect.
"At dis difficult time, we beg di public and media colleagues to respect di privacy of di bereaved family and stop to dey circulate unverified information or speculation on top di circumstances of im death," Owass fm tok.
For September, di 51-year-old bin deny rumours of im death afta one video of im appearance for public bin raise concern, but e confam say im dey battle some health challenges.
For inside some interviews afta im rare public appearance, e beg bloggers to dey responsible for dia report and verify information bifor dem rush to post am.
Tributes don begin enta for di late 51-year-old wey capture many pipo hearts for years on Ghanaian television.
Kwame Dzokoto bin act for one Ghana longest-running sitcoms for ova two decades.
im humorous and relatable character bin make many pipo love am plus im charm cut across generations.
Kwame Dzokoto bin rise to fame through im role as Judge Koboo for one popular Ghanaian television series Efiewura.
'Efiewura' don dey run on Ghanaian TV since early 2000 and di late Dzokoto feature for di series.
Apart from acting, Dzokoto na di host of Ghana most popular food TV programmes "Eziban".
Di food TV show (Eziban) dey throw light on local Ghanaian foods, dia unique preparation and cultural value.
Kwame Dzokoto bin host di culinary show on TV3 for more dan 10 years and e win plenty awards sake of di show.
E also build career in radio and television broadcasting, wia pipo sabi am for im presentation skills and connection wit audiences.
Outside entertainment, Dzokoto venture into politics and e contest for di Tarkwa-Nsuaem parliamentary seat on di ticket of di National Democratic Congress (NDC) for di 2016 general elections, but e lose di election.



















